Rumuekpe explosion for illegal refinery near Port Harcourt leave dozens dead

Rumuekpe explosion for illegal refinery explosion near Port Harcourt leave dozens dead

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Local oil refinery wey oil thieves dey operate for Bayelsa State for Niger Delta

At least 25 people don roast to death for illegal refinery explosion wey happun for weekend.

Local tori pipo and area pipo say children dey among di pipo wey die.

Illegal refining dey common for di oil-rich Niger-Delta region of Nigeria as poor area pipo dey tap pipelines to make fuel to sell make moni.

Eye witnesses say fire burst afta one crude oil pipe explode for one illegal oil refinery for Rumuekpe community.

Di place dey Emohua Local Government Area of Rivers State, south south Nigeria.

Rumuekpe explosion for illegal refinery explosion near Port Harcourt leave dozens dead

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Dis no be di exact secene of di explosion

Di blast wey happun for di illegal oil refinery destroy some plantation wey include palm trees plus some farms wey dey around.

Some pipo die wen di explosion happun but e neva clear if oda pipo wunjure and how many dem bi.

Some youths for many communities for Niger Delta, dey do illegal petroleum refining activities.

Rumuekpe explosion for illegal refinery explosion near Port Harcourt leave dozens dead

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Local crude oil storage wey dem construct for oil refinery wey oil thieves dey operate for Bayelsa State

Sometime di so-call refining of oil na just to boil crude oil for drum to remove di fuel.

As of 2020, Nigeria na di biggest oil producer for Africa.

Officials say di kontri dey lose about 200,000 barrels per day (bpd) of oil.

And dat na more than 10% of wetin e dey produce sake of tapping or vandalizing pipelines.

Dis tori don dey updated