You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
AMCON: Why Nigeria goment agency seize Abdulfatah Ahmed former Kwara governor mansion
Assets Management Corporation of Nigeria [AMCON] say dem don take over one of di property of Abdulfattah Ahmed, former Kwara state govnor.
Amcon officials also chase di occupants of di building wey locate for GRA, Ilorin.
Dr. Robert Ohuoba, one of Amcon Lawyer wey dey wit security operatives say wetin dem come do na to enforce a court order.
Abdulfatah Ahmed na Nigerian banker and politician wey serve as Govnor of Kwara State from 2011 to 2019 under PDP.
Tok-tok pesin for di corporation Jude Nwazor, don also confirm di action.
Amcon obtain court order
Part of wetin di Assets Management Corporation of Nigeria do na to also seal di building.
BBC sight a copy of di interim order wey Justice A.M Liman of di Federal High Court Lagos issue.
Trans Properties and Investment Limited, Trans IT and Consulting Limited na di oda parties wey join for di matter against former govnor Ahmed.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di court document show sey di Kwara former govnor matter wit Amcon na sake of a N4.6billion debt.
Former Kwara Govnor Abdulfatah Ahmed react
Immediate past Governor of Kwara State Abdulfatah Ahmed, don clarify tori sey Amcon seal im property for Ilorin, Kwara state.
Wahab Oba, wey be Ahmed tok-tok pesin for statement wey e bring out say di "dispute na based on a margin loan wey e secure from Intercontinental Bank and Finbank for 2009 for di purchase of shares wey die tied to unrelated loans obtained by odas.
Di banks hold di shares as collateral to sell and recover di loans in di event of a default.
Rather, di banks pass di loans to AMCON instead of selling di shares to recover di loan amount."
Oga Ahmed say im dey tok wit Amcon to separate di liabilities.
Who be Abdulfattah Ahmed
Abdulfattah Ahmed na two term former govnor of Kwara state, North central Nigeria.
Ahmed take over di regin of di state from former Senate President Bukola Saraki.
E run Kwara state from 2011 to 2019 before im party, di Peoples Democratic Party [PDP] lose to di All Progressives Congress [APC].
Abdulfattah Ahmed name follow for di names of odas including former Chairman of Independent Electoral Commission (INEC), Prof. Attahiru Jega; Professor Pat Utomi and former Minister of Education, Prof. Tunde Adeniran, wey just float di Rescue Nigeria Project [RNP].