Internet Fraud: Lekki for Lagos don turn "hotbed" for yahoo boys - EFCC

Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes commission (EFCC), say dem don arrest four hundred and two yahoo boys for di upper middle class area of Lagos, for internet-related fraud.

For statement wey di commission post for dia facebook page, say all di informate wey dem gada from investigate wey dem do from april reach june 2021, show say "Lekki district na di place wia all manner of yahoo boys prefer to live."

''Lekki, di fast-developing upper middle class area of Lagos Metropolis, don dey emerge as di new hub of internet-retaled fraud'' EFCC tok.

Di advance fee fraud and cybercrime sections of di Lagos command record total of 402 internet-related fraud arrest between April and June.

Di advance fee fraud do 243 arrest, while di cybercrime sector do 18 sting arrests from wia dem arrest 159 pipo, an dem don convict.

In recent times EFCC don do plenty arrests for Lagos and dem don convict some of dem.

On August 9, court give order make two yahoo boys Tobilola Ibrahim Bakare and Alimi Seun Sikiru, hand dia properties and cash over to di Nigeria goment.

Di property wey dem handover to di goment include N196, 741, 216.82 and N7, 054, 852.01 wey dey for bank; two motor, Mercedes Benz E500 and Toyota Hilux 2020 and one five bedroom duplex, one four bedroom semi-detached duplex and anoda four bedroom semi-detached duplex all for Lekki, Lagos.

Di two motor cost N30 million and di three duplex worth N230 million.