Kabul Airport and Afghan Taliban: US claim killing IS-K planner for Afghan drone strike

Wia dis foto come from, Reuters
US military believe say dem don kill one planner for Islamic State group for drone attack.
Dem say di attack happun for east of Afghanistan.
Islamic State Khorasan Province say na dem cari out di attack for Kabul airport.
US military action follow Thursday airport attack wey kill about 170 pipo including 13 American soldiers.
Mass airlift don dey go on for di airport since Taliban militants take over di Afghan capital dis month.
In di last two weeks, more than 100,000 pipo na im fit don move out.
Di deadline set by di US for dia sojas to leave Afghanistan dey expire on Tuesday.
President Joe Biden promise on Friday to hunt down di jihadists behind Thursday's suicide bombing.
End of Di one wey oda users dey read well well
UK Prime Minister don vow to "shift heaven and earth" to help pipo leave Kabul afta 31 August.
Boris Johnson make di pledge as UK evacuations enta final stage.
Meanwhile UK chief of defence staff say di evacuation of civilians go end on Saturday.
Britain ministry of defence say now dia focus na only on British citizens and oda pipo wey don already get clearance to leave.
Dem no go call more pipo come airport for evacuation, di ministry of defence tok.
According to one Nato official, all foreign military troop wey dey Afghanistan dey try cari dia pipo and embassy workers comot from di kontri.
Di suicide attackers bin target pipo wet stand for queue dey try leave di kontri afta Taliban militants takeover.

Who be IS-K?
Islamic State Khorasan (IS-K) say na dem dey behind di twin blasts for Kabul airport wey killed 90 wunjure more than 150 people.
But who dem be?
BBC security correspondent Frank Gardiner say di group na di most extreme and violent of all di jihadist militant groups in Afghanistan.
Im na regional branch of di group Islamic State and dem dey active for Afghanistan and Pakistan.
Di group don chop blame for some of di worst atrocities for recent years.

Wia dis foto come from, Reuters
Dem bin target girls schools, hospitals, and even one maternity ward wia dem shot and kill pregnant women, pikin dem, and nurse.
Dem be part of di international IS network wey dey attack di western, international and humanitarian targets once dem fit reach dem.
IS-K get links to Taliban through anoda groupthird party, di Haqqani network.
But dem get major differences wit di Taliban.
Dem dey accuse di Taliban of abandoning Jihad and battlefield in favour of peace settlement.
IS fighters don become major security challenge for di Taliban goment wey go soon enta.












