You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Naomi Campbell don born her first pikin!
Na baby girl!
Super model Naomi Campbell don welcome her first pikin, a bouncing baby girl.
For May 2017, Naomi bin tell tori pipo Evening Standard magazine say: "I dey tin about borning pikin all di time."
Di 50 years old super model announce di birth of her pikin for Instagram.
Inside di post she say: !One small beautiful blessing don choose me to be her mama, i dey so honoured to get dis gentle soul for my life words n dey to describe di lifelong bond wey I now share wit you my angel. No love pass dis one."
Who bi Naomi Campbell?
Naomi Campbell bi one of di most popular supermodels for di world.
Di supermodel don walk runway for most popular designers. She don also appear for TV and act for inside movies.
She also dey popular for di romantic relationships wey she dey get.
End of Di one wey oda users dey read well well
No bi only rich businessmen she don dey associated wit, but her fellow ogbonge celebrities dey.
Dis date-date tori don cos make her fans dey wonder who Naomi Campbell don date and weda she still dey follow dem yarn.