#EndSARS Protests: Accurate informate on di number of pipo wey die during #EndSARS Protests no dey available- US
![Nigeria [EndSARS] protest on February 13 Lagos and Abuja](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/5FDD/production/_116914542_index.jpg.webp)
Wia dis foto come from, EPA
Di United States Goment don tok say dem no get any informate on di number of pipo wey die during di #EndSARS Protests for Lekki Toolgate wey happun last year October.
According to di US Department of State's 2020 Country Reports on Human Rights Practices di accurate number of pipo wey die for di shooting during di #EndSARS Protests no dey available at di year end.
For one statement, di US Goment comfam say true true for October 20, 2020, some security pipo go enforce curfew by firing shot for air to comot protesters wey gather for Lekki Tollgate in Lagos to protest di abuse wey di defunct Nigerian Police Force's Special Anti-Robbery Squad (SARS) dey do di youths for di kontri.
Although Goment confam say true true sojas wey carry live ammunitions dey Lekki Tollgate dat night but only two pipo die for di incident, di number wey dey contrary to Amnesty International report wey say na 10 pipo die. No other organisation fit corroborate di Amnesty International Claim.
Oda things wey dey di report
Some oda things wey dey for di report include :
- For August 2020, a military court-martial convict one soja and sentence am to 55 years in prison sake of say he coimmit homicide when e dey deployed to Zamfara State
- Criminal gangs kill plenti pipo during di year. On January 25, crimnal abducat Bola Ataga. wey be wife of ne popular doctor and her two pikins from dia domot wey dey Juji community for Kaduna State. Dey kill Ataga some days later and free her pikins when di family no fit pay di ransom of $320,000 wey dem ask in exchange for their return.
Di US Department of State say dem go release additional informate to di report by mid 2021 and dis go expand di subsection on issues wey concern reproductive rights of women.
End of Di one wey oda users dey read well well










