You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
CNN Larry King: America television host Larry King [Lawrence Harvey Zeiger] die afta e catch Covid-19
Larry King, wey be Veteran broadcaster don die at di age of 87.
Na for di official Twitter handle of di American Broadcaster na im news of [Larry King death drop] wey be TV, radio host don die
King bin test positive for coronavirus for early January and dem acrri am go hospital inside Los Angeles,.
Im bin dey receive treatment for Cedars-Sinai Medical Centre for over a week.
King die on Saturday morning for Cedars-Sinai Medical Cente , Ora Media, im production company, confam inside statement.
After e catch Covid-19, dem bin admit am into hospital for condition wey serious sotey dem place am [Larry King] on a ventilator.
Larry King na ogbenge broadcaster wey be televison and radio host.
Before im death Larry King bin work for CNN wey be American cable network for a long time.
End of Di one wey oda users dey read well well
Larry King wey real name na [Lawrence Harvey Zeiger] bin live from November 19, 1933 until 23 January, 2021.