End SARS Protest: FCT security committee don ban street protest

Abuja don ban street demonstrations

Wia dis foto come from, officialFCTA

Wetin we call dis foto, Abuja don ban street demonstrations
Read am in 1 mins

Di FCT Security Committee for meeting don cancel all protests, gatherings and processions for Abuja, di Nigeria capital.

Di committee wey dey chaired by di FCT Minister, Malam Muhammed Musa Bello say dem chook eye into di directive of President Buhari and di dissolve order of FSARS by di Inspector General of Police and feel say di protesters dey cause kata kata for law abiding citizens.

Dem also tok say di Covid-19 guidelines still dey ground and di protesters no follow dem at all even as dem sabi say pipo get right to freedom of association.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

As tins be, dem don cancel any kain 'I-no-go-gree' waka for Abuja.

For inside di statement wey dem release, di security committee say even though dem recognise di right of citizens as regards freedom of association and movement, dem don observe say "di conduct of di crowd dey in complete violation of di Covid-19 safety protocols" wey dem put in oace to safeguard di lives of citizens.

Dem say di demonstrations dey "endanger di lives of not just di demonstrators, but also other citizens wey dey go about dia legitimate concerns".