Wike on Obaseki: Gov Nyesom Wike don pull out of Edo PDP reconciliation ahead of 25 June govnorship primary

Latest news about Obaseki be say Govnor Nyesom Wike don pull out of Edo PDP reconciliation
    • Author, Karina Igonikon
    • Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
  • Read am in 2 mins

Govnor Nyesom Wike of Rivers State don pull out of di reconciliation efforts for Edo State Chapter of Nigeria main opposition People's Democratic Party(PDP).

Dis dey happun barely a day to di important 25 June party primaries to choose who go fly di flag of PDP for di 19 September, 2020 govnorship election wey go happun for di Southern Nigerian State.

Di reconciliation committee suppose settle all di differences between party members, including tori of court ruling wey say make di Edo State Govnor Godwin Obaseki wey just port from di ruling All Progressives Congress (APC) enta PDP, no contest di Govnorship primary election.Gov. Wike tell tori pipo for in Port Harcourt say some members of di National Working Committee(NWC) of PDP na wetin him call 'sychophants and tax collectors' wey no dey tok truth.

Im say; "instead of di NWC to carry evribodi along for Edo state, dem dey use media to blackmail me."

"I tell dem say for Edo State, we must handle di issue carefully and carry evribody along. Dem must respect human beings and no behave like tax collectors."Dem say because order come from a Federal High Court in Port Harcourt, then I dey responsible. Me wey don get sleepless nights to resolve di issue for Edo state. Di Governors of Edo, Adamawa, and Delta states, know wetin I don do to resolve issues for Edo state.Because of dis senseless accusation, I don pull out of Edo State settlement. "My integrity matter to me." Wike tok.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Di Rivers Govnor come warn say if PDP no dey careful, di crisis for di All Progressive Congress (APC) go be a child's play, come add say im wan concentrate on di development of Rivers State.

Meanwhile Peoples Democratic Party (PDP) don clear throat come outside tok say no member of dia National Working Committee (NWC) sponsor any media publication to rubbish di pesin of Rivers State Govnor Nyesom Wike.

Di party describe di kain publication wey Govnor Wike dey tok about as handwork of external forces and enemies of di PDP wey dey gree-die on sow seeds of bad belle within di party.

Di NWC for statement wey Kola Ologbondiyan, di PDP National Publicity Secretary release just hours afta Govnor Wike comment, tok say dem wish to place on record say none of dia members don act like a "tax collector" in whatever meaning di term represents, either in di process leading to di Edo primary election, or any oda state.