Twitter put warning sign for anoda President Trump Tweet afta im sign social media executive order

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Ogechi Obidiebube
- Role, BBC News Pidgin, Lagos
- Read am in 3 mins
Twitter don sanction tweet wey America President Donald Trump tweet dis morning say im go use military to shoot if protesters for Minneapolis begin to steal.
Di social media platform say di tweet violate twitter laws and dey glorify violence. Twitter bin put warning for di tweet instead of make dem delete am.
Di warning say "Twitter don determine say e dey public interest for di tweet to dey inaccessible."
President Trump earlier tweet about protest wey dey go on for Mannisota sake of di death of George Floyd wey police kill on Monday. Di death don spark protest for di city.
Di president say he go "send in di National Guard", and follow with warning say "wen di stealing start, di shooting go start."
Di new policy to dey put warning for tweet wey start for middle of 2019 but Twitter never put warning or delete Trump tweet before until dis week wey dem fact check one tweet wey im do about polls for America.
After Twitter burst di tweet say na lie, Oga trump sign social media executive order to take regulate use social media platforms for di kontri.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
E don tey wen Trump dey kwanta wit social media companies because of di kain tins wey im dey always share online.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di latest quarrel happen on Tuesday, May 26 afta Twitter add fact-check links to im tweets for di first time.
White House neva share details of di executive order and e no dey clear which regulatory steps di presido go take without new laws wey Congress pass.
So, US President get power to shut down social media?

E no go dey straightforward like dat.
According to Harvard Law professor Laurence Tribe, Twitter no dey violate freedom of speech by adding fact-check link to Trump tweet. Unlike goment, Twitter na private company and dem fit moderate wetin users dey share without legal kwanta.
Di freedom of speech law for US no dey limit Facebook, Google, Twitter and oda social media networks. Instead, Professor Tribe explain say e dey limit di goment from violation of pipo freedom to say wetin dem want not private companies.
Meaning say, you no fit go jail for tins like blogging theories wey no dey true but di social network fit delete your account.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
If Trump shut down social media companies, na im go dey violate di freedom of speech law for US.

Wia dis foto come from, Getty Images
But wetin Trump fit do?
One tin wey Trump fit do na to regulate tech companies like Twitter through oda ways.
Im fit try to reverse Section 230, one law wey dey protect tech platforms make pipo no fit sue dem ontop content wey dia users post for dia sites.
Dis one go allow anybodi wey feel say dem be victims of anti-conservative discrimination for dis platforms to sue di platforms.
For now, di efforts to reverse di law neva get enough support.














