Coronavirus: How long coronavirus dey last ontop surface?

Pesin wey dey clean train station

Wia dis foto come from, Getty Images

As Covid-19 dey spread na so pipo dey fear to touch surfaces. Now for some public places around di world, pipo dey use dia elbows to open doors.

For places wia di virus dey worry wella, you go see pipo wey dey wear protective clothing dey spray disinfectant for plazas, parks and public streets.

Cleaning for offices, hospitals, shops and restaurants don increase.

Like many respiratory viruses, including flu, Covid-19 dey spread from tiny droplets from nose or mouth of pesin wey dey infected when dem cough.

One single cough fit produce up to 3000 droplets. These particles fit land ontop pipo , dia cloth and surfaces dem wey dey around dem but some of di particles fit hook for air.

Tori be say di virus fit dey inside pesin poo-poo, so anybody wey no wash im hand well-well afta im go toilet fit contaminate anything dem touch.

How long coronavirus dey last ontop surface?

According to di Centers for Disease Control and Prevention, touching of surface or object wey get di virus and then to touch pesin face " no be di main way di virus dey spread".

Even as CDC, World Health Organization and oda health authorities, do draw ear give pipo say washing of hands and to disinfect surfaces dey important to preventing Covid-19 spread.

But wetin wey no dey really clear na exactly how long Sars-CoV-2, di name of di virus wey dey cause di disease Covid-19 fit survive outside human being body.

Wetin we call dis Video, Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19

Some studies on oda coronavirus dem wey include Sars and Mers, dem find out say e fit survive for metal, glass and plastic for as long as nine days, unless dem disinfect am well-well. Some sef fit stay up to 28 days for low temperatures.

Neeltje van Doremalen, one virologist for US National Institutes of Health (NIH), and her colleagues for Rocky Mountain Laboratories for Hamilton, Montana, do some of di first tests of how long Sars-CoV-2 fit last for different surfaces.

Dem publish dia study for New England journal of Medicine, e show say virus fit survive for up to three hours afta pesin cough out for air and e fit remain airbone for several hours.

But di NIH study find out say Sars-CoV-2 virus dey survive longer for cardboard - up to 24 hours - and up to 2-3 days for plastic and stainless-steel surfaces.

Wetin we call dis Video, How to take care of pesin wey dey self isolate for house

Di study also suggest virus fit last log for door handles, plastic-coated or laminated worktops and oda hard surfaces. The researchers also find out say copper surfaces dey kill di virus in about four hours.

But fast option dey wey show say coronavirus fit dey inactive within a minute if you disinfect di surface with 62-71% alcohol or 0.5 hydrogen peroxide bleach or household bleach wey contain 0.1 sodium hypochlorite.

For cloth and oda surface wey dey hard to disinfect e no too dey clear yet how long di virus fit survive. Di absorbent natural fibres for cardboard fit cause di virus to dry up quick-quick than for plastic and metal na wetin Vincent Munster, head of di virus ecology section for Rocky Mountain Laboratories one of di pipo wey led di NIH study tok.