Nigeria village wey dey live without clean water

Wetin we call dis Video, Nigeria village wey dey live without clean water

Ezeukwu Alayi na community for Abia State for south east Nigeria with one major source of water wey be from stream.

During dry season, di stream usually dey dry up; dis dey make am difficult for di pipo wey dey live for di village to get access to portable water.

Tru one woman eye, we tell di tori of how e dey hard to get clean water and how dem dey cope wit access to water supply especially during di dry season.