You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ike Ekweremadu: Jolly turn katakata as IPOB members stone senator wit egg
"Come jollificate" turn to katakata for former Nigeria deputy Senate President Ike Ekweremadu, wen some IPOB members begin stone am wit eggs.
Igbos for Germany bin invite former deputy senate president Ike Ekweremadu come follow dem celebrate dia culture day on Saturday, but kasala gas as some members of di proscribed Indigenous pipo of Biafra, IPOB, waylay am no allow am enta di hall.
House of Rep member wey dey represent Aninri/Awgu/Oji River Federal Constituency, honourable Toby Okey Okechukwu, bin dey wit oga Ekweremadu wen di stoning happun.
Im say wen dem reach di venue for di occasion, some IPOB members rush come greet dem, den begin yan some kain tins wey Ekweremadu no understand.
E say, as dem no gree am enta hall n aim di former Senate president turn enta motor waka.
But video wey dey go viral for social media, show as dem dey drag, dey push am, no allow enta hall, den dem begin dey stone am.
Oga Toby say, German police bin arrest some of di culprits.
IPOB officials don deny say no be dia members do di stoning.
End of Di one wey oda users dey read well well