You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Notre-Dame Cathedral: Fire dey burn di ancient church
Di famous Notre-Dame Cathedral for Paris, France dey burn and di fire don spread to different parts of di building.
E neva clear wetin dey cause di fire, but authorities say e fit be sake of di renovation work wey dem dey do dia.
France president Emmanuel Macron, dey rush go wia di fire dey burn afta im cancel di national speech wey im plan to give im kontri pipo today.
Oga Macron say "like all my kontri men, I dey sad dis night to see dis part of us burn."
Last year, di Catholic Church for France do emergency launching to raise moni take save di 850 years old church wey don begin crumble.
Fire fighters dem don launch major operation to try stop di fire.