#BeyondFakeNews: Nigeria Muhammadu Buhari hail BBC as dem dey report correct tori

Nigeria Presido Muhammadu Buhari and Jamie Angus, Toyosi Ogunseye and Aliyu Tanko

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Wetin we call dis foto, From left to right: BBC Head of West Africa Languages Toyosi Ogunseye, BBC World Service Executive Director Jamie Angus, Nigeria President Muhammadu Buhari and Assistant Editor West Africa Aliyu Tanko

Nigeria Presido Muhammadu Buhari don draw ear give tori pipo alias journalist for di kontri make dem dey put extra effort to report correct informate.

Presido Buhari tok dis one on Wednesday wen BBC World Service Executive Director Jamie Angus go vist am inside Aso Rock for Abuja.

BBC Africa bin arrange Fake News conference wey dem use yan how tori pipo go take tackle as fake news dey spread for Nigeria.

Oga Buhari hail BBC as dem dey torchlight tori well well before dem report am.

Nigeria Presido Muhammadu Buhari and Jamie Angus, Toyosi Ogunseye and Aliyu Tanko

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Nigeria president also cut cap for BBC for di one wey dem dey tell tori give communities inside Hausa language across di Sahel region, and as dem begin tanda for Nigeria dey do news and programming wit Igbo, Yoruba and Pidgin.

Di presido still add say make tori pipo wash hand comot from fake news for di kontri.

BBC World Service Executive Director Jamie Angus wey lead di BBC team explain give di Nigerian leader say dem get ogbonge plans to cover di upcoming elections inside di kontri, including state govnorship debates.