You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jeff Bezos: World richest man dey divorce im wife of 25 years
Read am in 1 mins
Jeff Bezos, di oga kpatakpata of technology company, Amazon and im wife Mackenzie dey divorce afta 25 years marriage.
Bezos and Mackenzie announce di tori inside joint statement wey dem share for Twitter on Wednesday January, 9 2019.
Di couple say even though dem dey divorce, dem go continue to live dia lives as padi and if dem bin know say dem go divorve afta 25 years, dem go still do am again.
According to Bloomberg Billionaire Index, 54 years-old Bezos na di richest man for world and im net worth dey around $137 billion.
Di couple get four pikin togeda and one of dem dey adopted.