Lagos: 3 pipo die for Ojuelegba bridge accident - NEMA

Nigeria Emergency Management Agency say three pipo die wen load wey dey inside truck fall from Ojuelegba bridge on Tuesday night for Lagos.
Tori be say plywood wey truck carri fall from di bridge land on top at least three motors - two danfo bus and one private car around 9pm wen e happen, according to General Manager of Lagos State Emergency Agency Tiamiyu Adesina.
But Police say dem neva know how many pipo die.
Nigeria Emergency Management Agency - NEMA confam to BBC say three pipo die and plenti pipo wound and those wey wound dem dem carri dem go hospital.
But e be like say di number of pipo wey dey inside dis accident pass wetin NEMA tok as pipo dey post different numba of deadi bodi wey dem see wen di accident happen.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Police and oda emergency join bodi plus traffic officers manage clear di road early morning on Wednesday.

Road accident na big palava wey dey happun all always for Lagos and e don kill pipo wella for di main commercity of Nigeria.







