Ghana: Accra-Kumasi highway accident kill 11 pipo

11 pipo don die and plenti odas also wound inside one bad accident for Accra-Kumasi highway, southern Ghana.
Di accident happen on Tuesday when two buses from opposite direction jam each oda.
Dose wey wound dey receive treatment for hospital. 32 passengers survive the accident. But di fear be say di number of pipo wey die fit rise.

Ghana's National Road Safety Commission say e pass 300 pipo wey don lost dia life for di first two months dis year inside more than 2000 road accidents all ova di kontri.
Authorities say wetin dey cause most of di accidents na disobedience to road safety regulations.








