Emmanuel Macron: France election see current president win rival Marine Le Pen

Wia dis foto come from, Getty Images
France don vote to give Emmanuel Macron five more years as president instead of to replace am wit far-right candidate Marine Le Pen.
Dis na according to wetin French broadcaster project, afta di remaining polling stations close across di nation.
Di outcome go determine who govern France for di next five years.
Projections show say Emmanuel Macron secure a clear victory over far-right rival Marine Le Pen.
These projections wey French media prepare use a combination of real results and exit polls and dey considered ultra-reliable in di two-way contest.
Macron take 58% of di vote to Le Pen 42% in a narrower victory dan their previous contest for 2017
Macron, 44, go make history by becoming di first French president to dey re-elected in 20 years
Le Pen, 53, bin dey run for di presidency for a third time
End of Di one wey oda users dey read well well

'I be di president of all'
Macron don thank all those wey vote for am, and say e dey conscious say many vote for am to block di far right. E say e owe dem obligation for di years ahead.
E say e dey think of those wey abstain and wey no vote and also those wey vote for Le Pen wey now don dey disappointed.
"From now on, I no longer be di candidate of one camp, but di president of all.
"I tell those wey vote for di far right say my responsibility and dat of my team go be to address dia concerns."
"I go work for a more just society and equality between men and women," Macron tok.
"We need to show respect because our kontri dey so divided... no one go dey left by di wayside," e continue.
Di president also tok about how e go run di kontri for im second term. "Dis new era," e tok, "no go continue di methods of di past five years".
"Di Ukraine war show say we dey live through tragic times."
E conclude im speech by saying e dey proud to serve di French pipo again.

Wia dis foto come from, Getty Images
Marine Le Pen thank supporters
Marine Le Pen don express her gratitude to di pipo wey vote for her for di provinces, in di countryside and for France overseas territories.
She say di result - a projected loss - na still a victory for her party.
She respect di verdict of di ballot box, she tok.
Le Pen add say she go continue her fight in French politics - di far-right candidate bin tok previously say she might leave politics if she lost.
"Dis France too forgotten, we no go forget am."
She add say she go launch "a great battle for di legislative elections" which dey due to take place in June.
At di end of her speech, Marine Le Pen lead her supporters to sing La Marseillaise, di French national anthem.

Wia dis foto come from, Getty Images
European leaders congratulate Macron
President of di European Council, Charles Michel, don welcome di result and congratulate Emmanuel Macron on im projected victory.
Inside tweet, Michel add say di EU need a France wey dey committed to di project inside di katakata period on di continent.
EU Commission president Usula von der Leyen, also send greeting say she look forward to working with di re-elected president once more.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Our eye dey dis tori and we go dey update as we get details.














