Bola Tinubu: Taribo West prayers for Tinubu, ex-Super Eagles visit - Kanu Nwankwo react

Taribo West Tinubu: Ex-Super Eagles visit to Bola Tinubu - Kanu Nwankwo react

Wia dis foto come from, TWITTER

Read am in 3 mins

Wen Jay-jay Okocha, Kanu Nwankwo,Victor Ikpeba, Taribo West and oda ex-super eagles players visit Bola Tinubu dem no bin think am say e go spark conversation.

But di visit of di former Super Eagles footballers to Tinubu don provoke mixed reactions across Nigeria.

Now one of those wey visit di Lagos top polician don come outside to clear di mata.

Okocha, Kanu, Ikpeba, Taribo West and oda ex-super eagles players and Kanu Heart Foundation on Saturday go see Bola Ahmed Tinubu for im Bourdillon domot inside Lagos.

Dem give am award during di visit and on Sunday play novelty match in honour of di politician 70th birthday[on 29 March].

How Kanu Nwankwo react

Taribo West Tinubu: Ex-Super Eagles visit to Bola Tinubu - Kanu Nwankwo react

Wia dis foto come from, Twitter

But Kanu Nwankwo for video e post on im Facebook page, defend im association with Bola Tinubu, recalling how di politician help am 22 years ago.

"A lot of pipo don dey tok; all di same, we all dey entitled to our opinions.

"Of course, we gatz to talk. I no be politician; I be footballer and a proud one at that.

"I be a legend wey know wetin dey good and wetin no good." Nwankwo Kanu tok.

"22 years ago wen Kanu Heart Foundation bin dey look for pipo to support and help us touch lives, we get only three govnors and Ahmed Tinubu bin dey among dem.

"He give di foundation money; he support us and now e don reach im 70th birthday, we gatz to be dia to support him. We get a novelty game to play for him."

Kanu, wey bin do heart operation after e lead as Super Eagles captain to win Atlanta 96 Olympic Games, get a foundation wey dey take care of pipo wey get heart sickness.

Di Super Eagles legend then call on Nigerians to get dia permanent voters' cards ahead of 2023 elections in order to vote di right pipo into power.

However all wetin Kanu Nwankwo tok, no be so pipo see di mata. Local tori be say dia visit get sumtin to do wit Tinubu presidential ambition.

For early January 2022 Tinubu formally inform President Muhari Buhari of im intention to contest 2023 Nigeria presidential election.

Taribo West prayers for Tinubu go viral

Inside viral videos and pictures, Taribo West wey don turn to pastor pray for Tinubu.

Di former AC Milan defender ask im God to restore Nigeria to e rightful place through di Lagos based politician.

However, di retired footballers action recieve knocks on different social media platforms.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tinubu ex-Super Eagles visit remind pipo of Yahaya Bello

Tori be say di retired footballers, wey be mainly di class of 1994 and Atlanta '96 Olympics gold medallists, don equally visit Govnor Yahaya Bello of Kogi State last year.

Dat visit bin happun before one novelty match between di state executive council team and di combined sets of di 1994 and 1996 Eagles for di Confluence Stadium in Lokoja.

For dis latest visit to tinubu, di ex-internationals include Nwankwo Kanu, Austin Okocha, Victor Ikpeba and Taribo West.

Oda former Super Eagles players include; Peter Rufai, Tijani Babangida, Mutiu Adepoju, Garba Lawal, Julius Aghahowa, Victor Ikpeba, Uche Okechukwu, Ifeanyi Udeze, Taribo West, Victor Agali, Ike Shorunmu, Victor Ezeji, Obafemi Abiodun and Dosu Joseph.

Dem play novelty football match on Sunday for di Mobolaji Johnson Stadium inside Lagos State to mark Tinubu 70th birthday.

Bola Tinubu: Taribo West prayers for Tinubu, ex-Super Eagles visit - Kanu Nwankwo react

Wia dis foto come from, Twitter

Bola Ahmed Tinubu profile

Asiwaju Bola Tinubu na one of di most respected politicians for Nigeria.

Tinubu get popular title - Jagaban of Borgu

And many dey call am big oga for di kontri ruling All Progressives Congress political party.

Nigeria President Muhammadu Buhari describe am as one of di pipo wey work to create and develop di APC to di political party e be now.

Di politician na di former govnor of Lagos state for western Nigeria.

Im political career start as far back as 1992, when e join di Social Democratic Party wia im be member of di Peoples Front faction led by Shehu Musa Yar'Adua.

Im later enter di Senate, to represent di Lagos West constituency for di short-lived Nigerian Third Republic.

Afta dem cancel di results of di 12 June 1993 presidential elections. Tinubu become founding member of di pro-democracy National Democratic Coalition, one group wey mobilize support for di restoration of democracy and recognition of Moshood Abiola as winner of di 12 June election.

Tori bin dey circulate for social media say di APC chieftain get interest to run for di 2023 presidential election but im neva come out to make dat declaration of im interest for Nigeria next general elections.