Bianca Ojukwu: Drama for Soludo inauguration as Obiano wife and Bianca Ojukwu clash

Bianca Ojukwu and Ebelechukwu Obiano
Read am in 2 mins

Na drama for di inauguration ceremony of Anambra state govnor Prof Chukwuma Soludo wen di wife of outgoing govnor Willie Obiano, Madam Ebelechukwu and Madam Bianca Ojukwu clash for di event.

Di drama happun wen govnor Soludo take im oath of office.

Inside Live video coverage of di event, all di important personalities including former govnor Obiano don already sidon wen madam Obiano waka move straight to di front seat wia di widow of Dim Odumegwu Ojukwu bin sidon.

According to wetin BBC tori pesin wey bin dey ground tok, di former first lady bin come late to di event, ushers come give her separate seat somewhere else outside where Obiano [her husband] bin siddon.

On sighting di former Ambassador to Spain, she waka up to her and touch her for unholy and rude way.

Di former ambassador politely tell her say she no want her greetings, she again touch her for di second time before di former ambassador stand up in anger den di altercation start, before some dignitaries wey sit close intervene, dis happen as Governor Soludo bin dey take im oath of office today.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Idea no dey as to wetin fit don cause di fight between di two.

Di action draw di attention of security agents and some of di important personalities wey sharply pull Madam Ebelechukwu wey hold Bianca comot.

Bianca shock no be small by di action.

Dem later carry Madam Ebelechukwu Obiano comot and afta small time, her husband leave di venue as di mata happun afta dem swear in di new govnor.

Who be Bianca Ojukwu?

Bianca Odinakachukwu Olivia Odumegwu-Ojukwu (née Onoh, na Nigerian politician, diplomat, lawyer, and businesswoman.

She be di wife of former Biafran President, Ikemba Chukuemeka Odumegwu Ojukwu.

Born on 5 August 1968 Bianca get many international beauty pageant titles.

She win Most Beautiful Girl in Nigeria for 1988 and Miss Africa.

And she popular pass as di first African to win Miss Intercontinental.

For December 2011, President Goodluck Ebele Jonathan appoint her Senior Special Assistant on Diaspora Affairs.

And she bin serve as ambassador to Ghana and later become Nigeria Ambassador to di Kingdom of Spain for 2012.

Now she be permanent representative to di United Nations World Tourism Organisation.

Bianca get so many tittles from her native land including di highest title wey dem dey give women for her region.

Who be Ebelechukwu Obiano?

Ebelechukwu Obiano from Ogbunike, Oyi LGA and she grow for Onitsha all for Anambra state.

She bin work wit National Petroleum Investment and Management Services (NAPIMS), one of di eleven subsidiaries of Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) as Catering Supervisor, Corporate Procurement Officer and finally the Welfare officer.

She dey do charity programmes to help di less privileged and as first lady of Anambra state she set up Caring Family Enhancement Initiative (CAFÉ) for August 2014.

At some point she bin also work as marriage counsellor for her church.

She don win awards including United States of America, EU/UNICEF WASH Ambassador, and United Nations Peace Ambassador.