Ukraine invasion: Key facts about Zaporizhzhia Nuclear Power Plant Russia attack

Russian attack Europe largest nuclear plant for Ukraine, according to Ukraine president.
Volodymyr Zelensky accuse Russians of deliberately shooting at di Zaporizhzhia plant six reactors.
Ukrainian leader say di troops use tanks equipped with thermal imaging take attack di plant.
Zelensky raise fear about di "global catastrophe" wey bin happun for Chernobyl in 1986.
And e warn say consequences of a meltdown at Zaporizhzhia go be far worse.
Di fire be like wetin dey sparked by artillery shells, according to witness account.
Na around 4:00 GMT Friday morning tori land say firefighters reach Zaporizhzhya nuclear plant.
Dem quench di fire in di training building of Zaporizhzhya NPP.
End of Di one wey oda users dey read well well
"No victims dey for di fire" di State Emergency Service write on dia social media accounts.
Di fire burn Zaporizhzhia for at least four hours before dem quench am at about 06:20 local time Friday.
Zaporizhzhia Nuclear Power Plant significance
Dem build di Zaporizhzhia nuclear power plant between 1984 and 1995.
Zaporizhzhia NPP na di largest nuclear power plant for Europe.
Di plant wey dey Enerhodar, Ukraine na di ninth largest for di world.
E get six reactors, each dey generate 950MW,
Dis nuclear power plant fit produce a total output of 5,700MW.
And dis na enough energy for roughly four million homes.
For normal times, e dey produce one-fifth of Ukraine electricity and almost half di energy di kontri nuclear power facilities dey generate.
Di power plant dey located for south-east Ukraine for Enerhodar on di banks of di Kakhovka reservoir on di Dnieper river.
E dey about 200km from di Donbas region and 550km south-east of Kyiv.

No release of radioactive material - International Atomic Energy Agency
IAEA Director General do press conference just a while ago on di situation in Ukraine.
Rafael Mariano Grossi briefing start at about 10:30am afta Russia take control of Zaprizhhia nuclear power plant wey dey inside Ukraine.
Grossi confam say di Zaprizhhia nuclear plant dey under Russia control.
E however say na Ukrainians still dey inside di control room.
Im call for negotiation afta im return from im mission to Iran.
Di IAEA Director General indicate plans to consult Ukraine and Russia.
Di radiation monitoring system for di plant and oda safety concerns dey normal at di moment, e add.
IAEA - di International Atomic Energy Agency ma di world central intergovernmental forum for scientific and technical co-operation inside nuclear field.
Di agency dey works for di safe, secure and peaceful uses of nuclear science and technology.
E dey also contribute to international peace and security and the United Nations' Sustainable Development Goals.
Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant
Ukraine tok say Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant on Friday morning.
Russian troops don seize di Zaporizhzhia nuclear power plant, di Ukrainian authorities tok.
"Operational personnel dey monitoring di condition of power units," one local authority tok on social media, quoted by Reuters news agency.
Station personnel dey continue to work and monitor di state of the power units, dem tok.
Fire bin break out at di plant some hours ago - na di largest for Europe largest - after shelling attack by Russian forces.















