Deadly floods kill more dan 100 for Brazil Petrópolis

Wia dis foto come from, Reuters
More than 100 don die for landslides and flash flooding for Brazil city of Petrópolis.
Officials say heavy rainfall hit di city, destroy houses and cars.
Search and rescue teams dey search mud for survivors.
Di disaster happun for di Brazilian city of Petrópolis on Wednesday 16 February, 2021
Di city, wey dey located inside di mountains north of Rio de Janeiro, bin dey hit by torrential rainfall.
Houses wey tanda for hillside neighbourhoods dey destroyed.
And cars sweep away as floodwaters rough through di city streets.
Di city mayor don declare a state of emergency.
End of Di one wey oda users dey read well well
Search and rescue teams dey comb di mud for survivors.
Videos wey pipo share on social media show extensive damage and vehicles floating for streets.

Wia dis foto come from, Reuters
Not even buses fit withstand di force of di flood waters.
President Jair Bolsonaro, wey dey one official trip to Russia, don to say him go organise immediate help for the victims.Floods kill at least 38 pipo for Brazil.
More than 180 sojas don dey deployed and more specialised search teams dey expected to arrive later on Wednesday.
Inside one of di worst hit neighbourhood, 80 houses dey estimated to don dey damaged by di gushing water.
Petrópolis, wey be once summer residence of di Brazilian emperor, na a popular tourist destination.
But di location means e dey also prone to landslides.
Di worst incident happen in 2011, wen more than 900 pipo bi dey killed afta mudslides hit Petrópolis and neighbouring cities.














