Queen Elizabeth test positive for Covid-19

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Dulcie Lee
- Role, BBC News
Di Queen don test positive for Covid, Buckingham Palace don tok.
Di Queen dey experience "small cold-like symptoms" but expect to continue "smal-small duties" for Windsor over di coming week, di palace tok.
"She go continue to receive medical attention and go follow all di appropriate guidelines," dem add for di statement.
Di Queen, 95, bin dey in contact with her eldest son and heir, di Prince of Wales, wey test positive last week.
Tori be say some pipo don test positive for Windsor Castle, wia di Queen dey live.
Prime Minister Boris Johnson say e dey sure say "I speak for everyone for wishing Her Majesty The Queen fast recovery from Covid and a fast return to good health".
Leader of di Opposition, Labour Sir Keir Starmer, also wish di monarch "good health and fast recovery", e add say: "Get well soon, Ma'am."
Di announcement dey come weeks afta di UK longest reigning monarch reach her Platinum Jubilee of 70 years on 6 February.
End of Di one wey oda users dey read well well
On di day before her Jubilee, she carry out her first major public engagement for more dan three months, she meet charity workers for Sandringham House.
Di Queen, wey go be 96 for April, get her first vaccine for January 2021 and e dey believed say she don get all her follow-up jabs afta dat.
BBC royal correspondent Nicholas Witchell said she bin dey take life "more easily" since she spend a night in hospital for medical checks for October last year.
For November, di Queen miss di Remembrance Sunday service with her back wey get problem, weeks afta doctors advise am to rest afta she go hospital.
Na di first time she miss di ceremony for di Cenotaph for London as Queen, oda dan wen she dey pregnant or dey abroad.
While on light duties e dey likely say di Queen go dey read documents from UK goment ministers and Commonwealth representatives wey dem go send give am every day, she go dey approve and sign dem wia necessary.
Timeline: Di Royal Family and Covid

Wia dis foto come from, Getty Images
- March 2020: Prince Charles test positive
- April: Duke of Cambridge test positive
- January 2021: i Queen and Prince Philip collect dia first jabs
- February: Prince Charles and Camilla receive dia first dose dem
- 8 February 2022: Queen spend time with Prince Charles for one event for Windsor Castle
- 10 February: Prince Charles test positive for di second time
- 14 February: Camilla test positive
- 20 February: Buckingham Palace announce say di Queen don test positive












