Ukraine crisis: Biden warn say Russia fit invade next month

Russian tanks near the border with Ukraine

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Russia troops in di tens of thousand dey stand outside Ukraine border

American President Joe Biden don warn say di possibility dey say Russia fit invade Ukraine by next month.

Biden tok dis one for inside phone call with Ukraine president Volodymyr Zelensky on Thursday.

Russia on di oda hand don hala say dem no get plenti hope to resolve di kasala afta America no gree to dia main demands.

Dis na as di tens of thousands of Russian soldiers wey dey gada for Ukrain border still dey make pipo to fear say invasion go happun.

Howeva, Russia say dem no get plans to attack.

But for Biden call with Zelensky, e say America and dia allies and partners, dey ready to respond gidigba if Russia invade Ukraine, according to White House statement.

Oga Zelensky say dem "bin tok on diplomatic ways dem fit cool temper and agree on tins to do for future."

Dis na as military sabi pipo tink say Russia dey chill make di ground for Ukraine freeze first so dem go fit move heavy equipment enta di kontri.

A Ukrainian soldier on patrol

Wia dis foto come from, Anadolu Agency

Also on Thursday, US threaten to match brake on di opening of one ogbonge pipeline wey go send Russian gas go Western Europe if di invasion happun.

Nord Stream 2 go run from Russia to Germany but officials for Berlin say e go face sanction if Russia attack.

Already, di $11 bn pipeline still dey on hold to start operation as regulators for November say e no follow German law and no approve am.

Although Russia dey deny plans to attack, last month dem demand make di West no allow Ukraine to eva join di Nato military alliance. US reject di request but offer wetin dem call "serious diplomatic path forward" give Moscow.

Although dem no tok wetin di proposals be, US Secretary of State, Antony Blinken say di document make dia "core principles" clear, including say Ukraine get di right to choose to join security alliances like Nato.

A civilian participant for Kyiv Territorial Defence unit dey wait to put off mock attack while e dey train on a Saturday inside forest on January 22, 2022 in Kyiv

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ukrainian civilian take part in training exercise - Russian forces don dey mount for di border

Wetin dey hapun for Ukraine?

US President Joe Biden Biden say "beta consequences" go dey for di world if Russia try make a move on di nation, wey sit on im south-western border.

Im comments dey come as oda western leaders don repeat warnings say Russia go pay heavy price for invasion.

Russia don deny say dem dey plan any invasion but dem don seize di Ukrainian territory before and dem get an estimate number of 100,000 sojas dem send go near Ukraine borders.

Russia for a long time don resist Ukraine move to join body wit European institutions, and Nato in particular.

Russia say e no get plans to attack Ukraine: and armed forces chief, Valery Gerasimov don even deny reports say Russia wan attack Ukraine.

But tensions dey high and President Vladimir Putin don threaten "appropriate retaliatory military-technical measures" if wetin e call di West aggressive approach continue.

Nato secretary general warn say di risk of war dey real and President Biden say im dey guess say Russia go wan attack Ukraine.

Russia say for dem "E dey absolutely compulsory to ensure say Ukraine never, ever become a member of Nato," Deputy Foreign Minister Sergei Ryabkov tok.

Moscow accuse Nato kontris of "pumping" Ukraine wit weapons and accuse US of fuelling tensions. President Putin bin complain say Russia get "nowhere further to retreat to - shey dem tink say we go just sidon dey look?"

In reality Russia wan make Nato return to dia pre -1997 borders.

Dem no want more eastward expansion and dem want an end to Nato military activity for Eastern Europe.