Public Holidays in Nigeria 2022: Easter date, Labour day, Eid al-Fitr, bank holidays

Public Holidays in Nigeria 2022: Easter date, Labour day, Eid al-Fitr, national holidays

Wia dis foto come from, Alamy

2022 work dey resume from Tuesday 4 January, afta di new year day and Christmas festivities wey mark di end of 2021.

Public Holidays in Nigeria dey up to 20 times for 2022, and for some Nigerians e already dey for dia minds to plan dia diary to joli di new year.

And yes, many dey look forward to di better tins wey di year 2022 cari come including public holidays for di year.

Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day.

Dis na di likely public holidays wey di year 2022 carry for Nigeria and today wey be Monday 3, January 2022 dey among dem in continuation of di new year.

Public Holidays in Nigeria 2022

  • 1 January - Saturday - New Year Day
  • 3 January - Monday- New Year Day Holiday (Dis na because New Year day fall for Sunday)
  • 15 April - Friday - Good Friday
  • 18 April - Monday - Easter Monday
  • 1 May - Sunday - Labour Day
  • 2 May - Monday - Labour Day Holiday (Dis na because labour day fall for Sunday)
  • 3 May - Tuesday - Id el Fitri
  • 27 May - Friday - Children Day (Public Holiday for Schools and Children only)
  • 12 June - Sunday - Democracy Day
  • 13 June - Monday - Democracy Day Holiday (Dis na because Democracy Day fall on Sunday)
  • 10 July - Sunday - Id el Kabir
  • 11 July - Monday - Id el Kabir
  • 12 July - Tuesday - Id el Kabir Holiday (Dis na sake of say Id el Kabir dey likely to fall on Sunday according to di Lunar calendar)
  • 1 October - Saturday - National Day
  • 3 October - Monday - National Day Holiday ( Dis na sake of say di National Day fall on Saturday)
  • 8 October - Saturday - Id el Maulud
  • 10 October - Monday - Id el Maulud Holiday (Dis na because Id el Maulud fall on Saturday)
  • 25 December - Sunday - Christmas Day
  • 26 December - Monday - Boxing Day
  • 27 December - Tuesday - Christmas Day Holiday (Dis na as e be say Christmas fall on Sunday)

How Nigerian authority dey declare puplic holidays

Public Holidays in Nigeria 2022: Easter date, Labour day, Eid al-Fitr, national holidays

If any public holiday fall for week end, dem go declare di following week day as Public holiday.

Dis, according to how Nigeria Ministry of Interior dey announce public holidays over di years.

Na to compensate for di weekend wey pipo dey already dey accustomed to rest from work.