Myanmar court sentence Aung San Suu Kyi to four years in prison

Wia dis foto come from, Reuters
Former Myanmar leader, Aung San Suu-Kyi don dey sentenced to four years imprisonment.
Dem find am guilty say she cause kasala wen her party say make pipo no gree for coup.
Na one bin happun afta di military arrest am and break Covid rules wen she bin dey office.
Dis na di first judgement wey fit see di Nobel Prize winner spend di rest of her life for inside prison.
Suu-Kyi dey face 11 charges in total wey include corruption charges as well as violating di official secrets act.
She don deny all di accuse, since February wey di military collect goment from her with coup, she don dey for inside house arrest.
For now, e neva clear weda dem go carry her go prison.
No be only her get prison sentence on top di same accuse, Win Myint wey be di former president also gbab im own for years.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tok-tok pesin for di new National Unity Government wey be group of pro democracy pipo wey dey against coup tell BBC say she bin dey struggle.
Dr Sas accuse di military generals say dem dey prepare 104 years of prison sentence for di 76 year old.
"Dem want make she die for prison", na wetin im tok.
Wetin make military take ova power from Suu-Kyi

Wia dis foto come from, EPA
Di military take ova power for February 2021 afta dem call di 2020 general elections wey Aung San Suu Kyi party win wella say e bin get voter 419.
But independent election observers say di election bin dey free and fair.
Di coup come start protest around di kontri wey make Myanmar military start to use strong hand for pro-democracy protesters, activists and tori pipo dem,
Madam Suu-Kyi na just one in more than 10,600 pipo wey di junta don arrest since dem take power.
At least 1,303 also don die for inside protests, according to one monitoring group, Assistance Association for Political Prisoners.
Timeline of how Aung San Suu Kyi rise and fall
For 2010, dem release Aung San Suu Kyi afta she spend 16 years for house arrest.
In 2015, Suu-Kyi carry NLD win di first eva democratic elections for di kontri before she come enta di role of state counsellor for 2016.
For 2020 she lead di NLD to anoda elections victory but on February 1, 2021, di Myanmar military stage coup and arrest Madam Suu-Kyi hours before di new parliament suppose meet.
From February 3, to March 1, na im di military come charge am with all kain offences like.
- She get walkie-talkie wey dem no licence
- She go against Covid rules
- Violation of communication laws
- she bin wan cause public kasala
- Sedition
Ome May 24, dem carry Aung San Suu Kyi go court and na for dia she tok say, "NLD go exist as long as pipo exist".
Military sama anoda crime put di Nobel Peace Prize winner for June 10 wen dem charge am with Corruption charges. Dem say she collect 11 kg gold and $600,000.
From June 14 to November 30, her trial bin run for Naypyidaw and di sentence of 4 years for prison come on December 6.














