Pete Davidson: Kim Kardashian and Pete Davidson dey date?

Wia dis foto come from, Getty Images
Reality star, Kim Kardashian don land news again on top weda she dey date comedian, Pete Davidson.
Dem bin first collabo for public wen di fashionista bin host di American show Saturday Night Live, wia di comedian dey work for October dis year.
And now, many media organisations don claim say di couple now fit dey officially date.
According to E! News, source close to di 41 year old mother of four say dem dey officially date now, even though e dey casual and dem wan see how e go go.
Page Six don also declare say, dem dey officially togeda.
Di tori of Pete Davidson and Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Instagram
Tori be say, two of dem bin know diaself before but di pair reconnect for di filming of di show Saturday Night Live wey dem bin get skit wey dem kiss each oda.
Before dat one go calm down, picture catch dem for Halloween ride for October wey dem bin dey hold each oda hand as dem bin dey shout.
Tori come comot some days afta say dem go dinner togeda for one restaurant for Staten Island.
End of Di one wey oda users dey read well well
But di biggest clue for dia growing relationship na wen Pete Davidson spend im birthday for Kim mama house dey wear matching pyjamas with Kanye West ex.
Pete Davidson and Kim Kardashian dating history and wetin we know
Right now, Kim Kardashian dey go through divorce with di papa of her four pikin, Kanye West.
She don previously dey involved with Ray J, Nick Cannon, Kris Humpries among odas.
For im own right, Pete Davidson bin engage to singer Ariana Grande for 2018 but dat one no last.
E don also date Hollywood star, Kate Beckinsale and Bridgerton star Pheobe Dynevor.











