Iceland miss out on Europe first female-majority parliament after dem recount vote

Wia dis foto come from, Getty Images
Iceland briefly bin believe say dem make history by electing Europe first female-majority parliament - before dem recount and see say actually e remain small tin.
Women win 30 of di 63 seats (47.6%).
But earlier results bin show say women bin dey win 33 seats (52%).
No European kontri bin don pass di 50% threshold, with Sweden wey come closest at 47%, according to data from di Inter Parliamentary Union.
Di results mean say a further six women don dey elected to Iceland parliament, but men still hold majority of di seats.
Unlike some oda kontries, Iceland no get legal quotas on female representation for parliament, though some parties require a minimum number of candidates to be women.
No oda European kontri don break di 50% threshold, with Sweden wey come close with 47%, according to data from di Inter Parliamentary Union.
Unlike some oda kontries, Iceland no get legal quotas on female representation for parliament, though some parties dey require a minimum number of candidates to be women.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di kontri for long don dey considered a leader in gender equality and dey ranked as di most gender-equal nation for di world for di 12th year running inside di World Economic Forum report wey dem release in March.
E dey offer di same parental leave to both men and women, and di first law on equal pay for men and women go back to 1961. Na also di first kontri for di world to elect a female president for 1980.
One of those dem elect na Lenya Rún Taha Karim of di opposition Pirate Party, who, for just 21, become di youngest MP for di kontri history.
Just five oda kontries currently get parliaments where women hold at least half di seats. Rwanda lead di way, with women making up 61.3% of di members of di lower house.
E dey followed by Cuba on 53.4%, Nicaragua on 50.6% and Mexico and di United Arab Emirates at 50%. Women make up just 34.2% of di members of di United Kingdom House of Commons and just 27.6% of di House of Representatives in di United States.
Meanwhile, yesterday election see incumbent left-right coalition goment, wey Prime Minister Katrin Jakobsdottir, dey lead increase im majority.
We don update dis tori.












