Zambia election result: Hakainde Hichilema declared winner, Lungu accept defeat

Wia dis foto come from, AFP
Zambia incumbent president Edgar Lungu don congratulate president-elect of the kontri Hakainde Hichilema on e victory for last week polls.
Lungu for live broadcast tok say: "I go like to congratulate my brother Hakainde Hichilema for being elected as di 7th president of mother Zambia".
After e lose elections five times, Zambia opposition leader Hakainde Hichilema win di 2021 elections.
Im bin face e long time rival Lungu wey claim say di elections bin no dey free and fair after he lose votes for some of e traditional strongholds.
Im say dem chase election officials from e Patriotic Front party comot from polling stations, come leave dia votes unprotected.
In response, Hichilema United Party for National Development say di statement na "desperate final act of an outgoing administration".
Now, after 21 years as opposition party di tables don finally turn for Zambia United Party for National Development.
Di electoral commission declare businessman Hakainde Hichilema president elect after three days of counting votes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Champagne bin dey flow as celebrations start for di election results centre and for di streets of di capital Lusaka.

Oga Hichilema win di elections by more than one million votes against long time rival outgoing president Edgar Lungu wey im 6 year rule bin dey characterized by alleged human rights abuses, corruption, failing economy and massive unemployment.
Di landslide win mean say Hichilema no go fight run-off contest.
"I therefore declare Hichilema to be president of Zambia," commission chairman Esau Chulu announce for di results centre for Lusaka.
E no dey clear wetin oga Lungu go do next after e claim say di elections no dey free and fair and call for cancellation of di elections.
Di president elect dey expected to take im oath of office in di next 7 days.
President-elect Hichilema now dey face di challenge of turning around di kontri economic fortunes.













