Haiti earthquake today kill 304 pipo, damage buildings and injure 1,800

A drone photograph of the damage caused by a 7.2 magnitude earthquake in Les Cayes

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Buildings bin dey damaged and reduce to rubble for di town of Les Cayes
Read am in 2 mins

One powerful earthquake hit di Caribbean nation of Haiti, e kill at least 304 pipo and injure more than 1,800.

Di quake happun on Saturday morning about 7.5 miles northeast of Saint-Louis du Sud, wey no dey too far from di capital Port-au-Prince.

Di prime minister say there "extensive damage" na im di earthquake cause and declare one month-long state of emergency.

Haiti still dey recover from serious earthquake wey bin happun for 2010.

According to di U.S. Geological Survey di earthquake na about 7.2 magnitude wey happen for Saint-Louis du Sud.

US Geological Survey bin estimate say na "thousands of fatalities" and "tens of thousands of injuries for poor mountainous communities" for Haiti fit don happun afta di magnitude 7.2 earthquake.

Videos online for social media show damaged buildings like hotels and churches.

Prime Minister Ariel Henry say im don mobilise team to work on relief effort.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

"Di most important tin na to recover as many survivors as possible under di rubble," im tok. "We don learn say di local hospitals, in particular that of Les Cayes, dey overwhelmed wit pipo wey wunjure, fractured pipo."

Oga Henry later reveal say im don fly inside plane over di city of Cayes.

US President Joe Biden don authorise "immediate US response" to help Haiti and e tok say USAID go work to support efforts to "assess di damage and assist efforts to recover those who dey injured and those wey must now rebuild".

"For wetin already be challenging time for di people of Haiti, I dey sad by di devastating earthquake," im tok.

Map of the epicenter

Di USGS earlier warn say di earthquake fit result in thousands of fatalities and injuries. Dem also say dem feel many aftershocks for di region, including one wey measure 5.8 magnitude.

Naomi Verneus, wey be 34-year-old resident of di capital Port-au-Prince, tell di Associated Press news agency say di earthquake wake her up and her bed bin dey shake.

"I wake up and bin no get time to wear my shoes. We survive di 2010 earthquake and all I fit do na to run. I later remember my two children and my mama bin still dey inside. My neighbour go inside and tell dem to get out. We run to go street," she tok.

For 2010 one 7.0 magnitude earthquake kill more dan 100,000 pipo for Haiti.

Di 2010 incident bin hit di capital, Port-au-Prince. E cause extensive damage to infrastructure and dia economy.