"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography - Duchess of Sussex life story

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di Duchess of Sussex inside Morocco in February 2019
Read am in 11 mins

Crisis meetings involving senior royals for Burkinham Palaca don take place afta di Duke and Duchess of Sussex interview wit Oprah Winfrey.

Prince Harry and Meghan bin tok about racism, mental health, di media and oda royals for di interview.

Rachel Meghan Markle - di first mixed-race member of di modern Royal Family - say her low point na when was unnamed royal family member ask Harry "how dark" their son Archie skin fit be.

Kack make BBC Pidgin cari your eyes look at di life story alia profile of di Duchess of Sussex, "Meghan Markle".

Meghan Markle don already make her name as an actress, campaigner and blogger before she marry Prince Harry for May 2018 and become di Duchess of Sussex.

Before she meet Prince Harry, she bin dey popular for one US TV drama "Suits" wey she play di role of a lawyer, Rachel Zane.

Wen she turn member of di Royal Family, she quit her acting career - and occupy herself wit di life of a working royal, as she dey use di platform to showcase charities and matters wey dey close to her heart.

She become a mother for May 2019 but within a year she and Prince Harry don waka comot from working as members of di Royal Family and start dia new life for North America.

She dey live for California now and dey expect her second child.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography
Wetin we call dis foto, Prince Harry bumped forearms with Craig David when they met at the end of the service - while Meghan opted to hug him

Early life

Dem born Rachel Meghan Markle for 4 August 1981, she grow up for di posh part of Los Angeles.

Her mama town na one area dem dey call di "Black Beverly Hills".

Meghan bin attend private primary school for Hollywood and start dey campaign for gender equality when she still dey small.

Wen she dey 11 years old, she write letter to di then US first lady, Hillary Clinton, on top one washing-up liquid TV ad strapline: "Women all over America are fighting greasy pots and pans." Wey she say e no good.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Karwai Tang

Wetin we call dis foto, Meghan, Duchess of Sussex and Prince Harry, Duke of Sussex attend di Commonwealth Day service for Westminster Abbey in March 2019

Within a month, manufacturers of di product, Procter and Gamble change di word "women" to "people".

"Na dat moment I realise di magnitude of my actions," she later tok. "I bin create my small level of impact by standing up for equality."

At 15, she volunteer for soup kitchens as her studies continue at one girls' Roman Catholic college, and she graduate from Northwestern University School of Communication, near Chicago, in 2003.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography
Wetin we call dis foto, Meghan Markle family tree

She work as an intern for di US embassy for Argentina make her reason say her path fit lead her into politics, but she later change course when her acting career begin to take off.

Between auditions, she bin make money by doing calligraphy for wedding invitations, using di skills she learn for handwriting classes at school.

Her father na cinematographer on di hit 1980s show Married... With Children, and her first television appearance for di US na one episode of di medical drama General Hospital for 2002, before she move on to roles in CSI, Without a Trace and Castle.

She get leading roles for TV movies like When Sparks Fly and Dater's Handbook, and small-small parts for Hollywood films including Get Him to the Greek, Remember Me and Horrible Bosses, and she was a "briefcase girl" on di US version of game show Deal or No Deal.

Wetin we call dis Video, Watch Meghan Markle inside one US wedding drama

She also appear for di sci-fi series Fringe, she play di role for di FBI special agent Amy Jessup, but her most famous role na for Suits.

Meghan bin dey di show from di time dem launch am for 2011, but she later comot for di finale of di seventh series, maybe because her her character got married.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

For real life, Meghan marriage wit Prince Harry no be her first marriage. For September 2011, she marry film producer Trevor Engelson, but di marriage scata and dem divorce two years later.

For September, report carry am say her former husband dey produce one new TV show wey di storyline na man custody battle with im ex-wife wey marry into di Royal Family.

For 2014, she begin dey write on topics like food, beauty, fashion and travel, as well as her own story, on her lifestyle website The Tig.

Meghan tok say di reason why she set up di website na to "reframe di beauty content to include think pieces about self-empowerment" and feature dynamic, inspirational women.

In one post, she explain say: "I' no ever one be dat lady wey dey launch - I wan be dat woman wey dey work."

She also dey write about her birthday for di site. When she turn 33 for 2014, she write: "My 20s dey brutal - a constant battle wit myself, Idey judge my weight, my style, I wish to dey cool/as hip/as smart/as 'whatever' as everyone else."

She also grow large social network profile, wit 1.9 million followers on Instagram and more dan 350,000 on Twitter.

But she close The Tig for April 2017, and delete her social accounts for January 2018.

Her media career don go wit things wey dey important to her.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, World Vision Canada

Wetin we call dis foto, Meghan teach children to paint with watercolours during one 2016 visit to Rwanda as a global ambassador for World Vision

She tackle di issue of di stigma around menstrual health inside an article for Time magazine for March 2017 and she be global ambassador for World Vision Canada, wey dey campaign for better education, food and healthcare for children around di world.

As part of her role, di actress travel go Rwanda for di charity's Clean Water Campaign.

Meghan commitment to gender equality don make her work wit di United Nations, and she receive a standing ovation from an audience wey include di UN Secretary General Ban Ki-moon for a stirring speech on International Women's Day 2015.

Commenting on how she combine acting wit campaigning, she say: "While my life shift from refugee camps go red carpets, I choose both of dem because these worlds can, in fact, co-exist. And for me, they must."

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Meghan Markle don about her pride inside her mixed racial heritage

Meghan, wey im papa na white and im mama na African-American, tok how she take come to terms wit her racial identity.

For one article for Elle magazine, she write: "While my mixed heritage fit don create some kain grey area around my self-identification, and don keep my foot on both sides of di fence, I don come to accept am."

"To tok who I be, to share where I come from, to voice my pride in being a strong, confident mixed-race woman."

Marriage to Prince Harry

For late 2016, Prince Harry confam say im get relationship withMeghan - while issuing a statement accusing journalists of harassing her.

Di two of dem bin meet on a blind date, wey one friend arrange. Afta just two dates, dem travel go Botswana for holiday.

In September 2017, Meghan tell Vanity Fair magazine say dem be "two pipo wey dey very happy and in love".

And inside one interview for November, wen dem announce dia engagement, Prince Harry tok say im never hear of Meghan before im friend introduce dem, and e dey "beautifully surprised".

Meghan and Prince Harry marry for St George's Chapel, Windsor, on 19 May 2018.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen give dem di title of di Duke and Duchess of Sussex on dia wedding day
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Thousands of members of di public turned out for di couple wedding

Royal Tours and engagements

Meghan and Prince Harry embark on dia first royal tour together for October 2018 - dem visit Australia, New Zealand, Fiji and Tonga over 16 days.

Na for di trip di couple announce say dem dey expect dia first baby.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Meghan for di British High Commissioner domot inside Suva, Fiji

Di duke and duchess follow di footsteps of Prince Harry's parents - Prince Charles and Diana, Princess of Wales - wey dia first royal tour na to Australia and New Zealand.

Meghan Markle biography [Where is Meghan Markle from?]: Queen Elizabeth grand-pikin Prince Harry Duchess of Sussex, Rachel Meghan Markle profile

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Harry and Meghan for Taronga Zoo inside Sydney
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Meghan and Prince Harry for di unveiling of di Labalaba Statue inside Nadi, Fiji
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, In February 2019 di Duke and Duchess travel to Morocco for a three-day visit

In September 2019, di couple undertook a 10-day tour to Africa, di continent wey dey very dear to Prince Harry heart. Dis tour make pipo dey reason for early part of dia marriage say dem fit at some stage choose to live there.

Meghan meet Archbishop Desmond Tutu and Sophia Williams-De Bruyn, as well as other key figures for South Africa anti-apartheid movement.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Handout

Wetin we call dis foto, Sophia Williams-De Bruyn bin dey 18 years old wen she help lead about 20,000 protesters
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Chris Jackson/PA Wire

Wetin we call dis foto, Prince Harry and Meghan meet Nelson Mandela's widow, Graca Machel, for one reception inside Johannesburg

She also meet wit business pipo for Johannesburg and she tell dem say dem get power to change a world wey look "aggressive, confrontational and dangerous"

But by di end of di tour, wetin di couple's tok about fighting injustice dey reported alongside news na say dem don begin legal action against Mail on Sunday say dem publish one private letter wey di Duchess of Sussex send to her papa.

Becoming a mother

When Meghan born her son Archie Harrison - on 6 May 2019 - di reaction from di New York Times show di mass interest of di event around di world as dem write: "He be di first multiracial baby of di British monarchy' recent history, an instant star for di kontri where multiracial children make up di fastest-growing ethnic category."

But di royal couple don already decide to do things a little differently, as dem determine say dem no go follow di traditions of other recent royal births.

In advance, dem chose not to reveal where dem go born di baby and di whole process no go dey for public eyes because di tradition na tori pipo and "royal superfans" go don camp outside di hospital for several days to try see di new royal baby.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Prince Harry and Meghan wit baby Archie

And di birth no dey announced in di traditional royal way, wey dem go post placard outside Buckingham Palace. Instead, Prince Harry comot from di house to tell di world (although dem later place di placard).

Di very private naming ceremony wey follow just make some media pipo tire because for dia mind, dem no fit fully report one of di happiest story for di year. Dem do di naming for Windsor Castle, and for di ceremony no press photographers or TV cameras cover am and dem no put di list of guests and godparents for public.

BBC royal correspondent Jonny Dymond tok say e mean say di duke and duchess wan raise their son Archie out of di spotlight.

A very public departure from royal life

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, VICTORIA JONES/PA

Wetin we call dis foto, Now you see them....
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, The couple's final engagement as working royals saw them in the familiar surroundings of Westminster Abbey
"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, VICTORIA JONES/PA

Wetin we call dis foto, ...now you don't. Madame Tussauds removed Harry and Meghan from its royal set, leaving an empty space

As media dey ginger issues through dia lawyers, e go soom dey clear both Meghan and her husband were becoming increasingly no expect di conditions wey dey attached to dia royal role.

Di announcement for June 2019 say dem dey break away from di Royal Foundation charity - wey don make dem work closely wit di Duke and Duchess of Cambridge - make pipo dey reason about Prince Harry and Meghan relationship wit Prince William and Catherine.

Di Queen and Prince Harry bin tok before di couple later confirm say dia final duties as working members of di Royal Family go end for March 2020.

For di very final engagement, dem attend di Commonwealth Day service for Westminster Abbey. Di Queen, Prince Charles and Prince William all of dem dey there.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, Getty Images

Then tori bin fly say dem use £2.4m of taxpayer money renovate dia house - Frogmore Cottage,before e later come out say na Prince Harry pay di money for di renovation.

Meghan comments during di couple's African tour say she no get enough support as she struggle wit motherhood and her new role no go down well wit senior royals, according to sources at di time also cause some gbege for di family..

At di end of 2019, di couple take Christmas break from royal duties, and carry Archie go di Canadian province of British Columbia.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Di couple and their son Archie bin spend some time for Canada over Christmas 2019

Dis one give dem time to think over their next move and, within days of 2020, dem drop di bombshell announcement say de plan to step back as senior royals and become financially independent.

Buckingham Palace express dia disappointment as palace sources reveal say no oda other royal - including di Queen or Prince William - dey consulted before dem issue di statement.

Prince Harry and di Queen later meet to iron out di details before dem confam di couple's final duties as working members of di Royal Family go end for March 2020.

"Meghan Markle" Prince Harry Oprah Winfrey interview: Rachel Meghan Markle biography
Wetin we call dis foto, Prince Harry bumped forearms with Craig David when they met at the end of the service - while Meghan opted to hug him

In February 2021, before a formal review of di situation start, Buckingham Palace confam say di Duke and Duchess of Sussex no go return as working members of di Royal Family.

Emean say Prince Harry and Meghan go return their honorary military appointments and royal patronages, wey dem go redistributed to working members of di Royal Family.

Di couple go still attend some royal events for future but dem no go label dem as official duties.

A new life in LA - and fighting new battles

Afta some time for Canada, di couple settle down for a new home for California.

E give dem plenty time to dey wit Meghan mama Doria Ragland, wey dey live for di state.

But dem still dey spotlight. Media still dey track di couple whereabouts for di early days of di coronavirus lockdown. For April 2020, dem sue and eventually win an apology from one US news agency afta claims say dem use drones take fotos of their son, Archie, for their home.

Di same month, di couple announce say dem dey end all co-operation wit four tabloid newspaper groups for di UK, sake of "distorted, false or invasive" stories.

But dem still need di public to support di causes and issues wey interest dem.

As a duchess, Meghan start to dey do charitable work and patronages, wey include di National Theatre and charity Smart Works. She also launch a charity cookbook for September 2018 to help those wey dey affected by di Grenfell Tower fire.

"Meghan Markle and Harry interview wit Oprah Winfrey": Meghan Markle biography - Duchess of Sussex life story

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Meghan was joined be her mother, Doria Ragland, and Prince Harry for the cookbook launch

Afta she return to di US, she jointly write a newspaper article wey call for di end of "structural racism" and di couple also encourage di US citizens to vote for di presidential election, say make dem reject hate.

In November 2020, Meghan write one article wey expose her "almost unbearable grief" wen she get miscarriage in July of that year.

"Meghan Markle and Harry interview wit Oprah Winfrey": Meghan Markle biography - Duchess of Sussex life story

Wia dis foto come from, Getty Images

Concerning their future career plans, a big clue come wen dem reach a deal wit streaming giant Netflix to do some programmes, some of which dem fit appear inside.

Meghan and Prince Harry feature for plenty headlines for February 2021.

At one High Court for London, Meghan win her claim for misuse of private information against di publisher of di Mail on Sunday and MailOnline, on top di publication of extracts from one letter to her father. Another hearing go decide di "next steps" in her legal action wey cover claims of copyright infringement and breach of di Data Protection Act.

Days later Meghan and Harry announce say dem dey expect dia second pikin.

Then the news come say di couple don decide to tok about their decision to step away from di monarchy, for one TV interview wit Oprah Winfrey.

And anoda statement from Buckingham Palace say dem go investigate claims say di Duchess of Sussex bin bully one royal staff for 2018.

Her tok tok pesin say di duchess dey sad wit di "latest attack on her character" - and di following day, CBS release one clip from her Winfrey interview where Meghan tok say Buckingham Palace no expect make she and Harry dey quiet if dem dey lie about dem.