Trump impeachment: Democrats formally introduce article to Congress

Wia dis foto come from, Reuters
Democrats don formally introduce resolution to impeach Trump for im role for last week violence during di brief pro forma session wey happun for di House of Representatives dis morning.
Di document accuse Trump of "incitement of insurrection," and claim say Trump actively encourage violence for di US Capitol.
Di article point to several false claims wey Trump make, including say di election dey "stolen" from im and say e be di rightful winner of di 2020 vote.
As dem promise, di Democrats introduce resolution calling on Vice-President Mike Pence to convene di White House cabinet to hold meeting on weda to discharge Trump from office under di 25th Amendment to di US Constitution.
Di brief pro forma session adjourn in less dan 15 minutes afta objection to di resolution by one Republican lawmaker from West Virginia. Di session go continue tomorrow.
If Pence no act to remove Trump, as most experts expect, di House go begin debate on Wednesday on di article of impeachment wey dem file today accusing Trump of inciting insurrection.
Di sponsors of the impeachment bill say dem already get enough votes for am to to pass di House on Wednesday.
If dem impeach Trump for a second time, di Senate go hold trial to decide weda or not to convict am of di political charge.
End of Di one wey oda users dey read well well
Democrats say di trial fit no happen immediately, as di Senate get more pressing concerns such as pandemic-related financial relief wey go take lead for di first month of Biden term.
Trump imsef never make any public statements since Friday, wen dem ban am from social media platforms.
Trump dey comot office on 20, January, wen President-elect Joe Biden inauguration go happen.














