Trump Twitter: Donald Trump tweets vex election rival Joe Biden, Michelle Obama afta im Walter Reed return as Facebook, Twitter block am

Donald Trump latest on Joe Biden afta Walter Reed return

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Donald Trump
Read am in 3 mins

Facebook and Twitter don take action against America President Donald Trump post wey put to claim say Covid-19 no dey serious pass flu.

Facebook remove di post and add warning say na misinformation about coronavirus before users go fit click to see am. Twitter also no allow pipo share di tweet."As e be standard for public interest notice, engagement for di tweet go reduce" Twitter tok tok pesin add.

Tori be say US president Donald Trump first day afta im comot hospital wia im bin dey get Covid-19 don dey busy for am, if pesin use im latest yarn ontop social media take judge.

Small time afta President Trump return from Walter Reed Hospital on Monday, wen pipo go expect for am to dey rest, e release two videos and tweets ontop social media.

In one of di video, e tell American say make dem no fear di virus, say US get di best melecine for am and "vaccines go soon land".

But in di following 12 hours, oga Trump don release more tweets wia im accuse im rival "Joe Biden" and Democrats ontop abortion mata, tok why covid-19 no suppose make dem close di country and hala "Feeling Great!

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

One tweet quote on New Your Post journalist Miranda Devine wey say Trump go be invincible hero, "wey no just survive every dirty trick di Democrats do ontop am, but di Chinese virus join".

Donald Trump latest on Joe Biden afta Walter Reed return

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Trump return from hospital on Monday night

"Flu" tweet

Oga Trump compare flu (cold and catarrh) wit Covid-19, say afta all over 100,000 pipo dey die from flu everi year from im kontri - even though vaccine dey from am.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

But tori pipo Aljazeera release tweet wey dem say US Centre for Disease Control (CDC) informate no tally wit di 100,000 wey Presido Trump tok.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Donald Trump latest on Joe Biden afta Walter Reed return

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Trump

"Bloomberg" tweet

4:36pm (WAT). Trump fire yabis go Michael Bloomberg domot say di number 14 richest billionaire for di world (Forbes) no try for one debate. E call oga Bloomberg "Mini" Mike Bloomberg.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

"Abortion" tweet

Trump accuse Biden say di former vice-president dey favour make won do abortion very late for di pregnancy and even after she don born.

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 5

"Debate" tweet

And just in case im supporters dey worry say im no go fit make am to di next presidential debate, trump release dis:

Skip X post, 6
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 6

Former first lady Michelle Obama use her closing message to Americans in one campaign video wey she release today less than a month before Election Day, saying President Donald Trump and im padi-padi dey "put fears about Black and Brown Americans" to win election and she call di President actions "morally wrong" and "racist."