Kanayo O. Kanayo: Anayo Modestus Onyekwere become lawyer at 58 afta years of Nollywood career

Wia dis foto come from, MOmodu media/kanayo/instagram
Nollywood actor Kanayo O Kanayo turn professional lawyer at age 58 afta many years of im acting career.
K O K become Nigeria 'latest lawyer' on 15 September, 2020 wen im call am to di Nigerian Bar as Barrister and Solicitor of di Supreme Court of Nigeria.
Di 58-year-old actor bin announce am for social media wit fine foto of am wia im wear wig and gown for lawyers.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
Who be Kanayo O. Kanayo?
Many pipo dey always surprise to find out say im real name na Anayo Modestus Onyekwere.
Di Imo state-born actor bin act for di ogbonge 1992 feem 'Living in Bondage' and im don act for over 100 feems since den.

Wia dis foto come from, Momodu Media
One of im most recent feem na 'Up North' wia im feature wit singer Banky W and actress Adesuwa Etomi. Im also act for di continuation of di blockbuster feem 'Living in Bondage: Breaking Free".

Wia dis foto come from, Momodu Media
Kanayo say e don tey wen im don dey dream to become lawyer, na so di actor shock evribodi for 2015 wen im enrol for University of Abuja to study Law.
Im bin graduate for 2018, im come go di Nigerian Law School for Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well














