Thailand king don give im royal wife Sineenat Wongvajirapakdi wey fall from grace her title back

Wia dis foto come from, Reuters
Thailand king don give im disgraced royal wife her title and position back, nearly one year afta im comot am.
King Vajiralongkorn return Sineenat Wongvajirapakdi rank and titles on Wednesday, di Royal Gazette announce.
Im comot Sineenat from her rank for October 2019, only months afta dem name am as di king companion.
Di palace say she collect punishment sake of say she bin dey try elevate herself to di "same level as di queen".
Sineenat na di first royal consort for almost 100 years for Thailand, for wia di name mean woman wey be partner in addition to di king wife.
Last year announcement also accuse her of "misbehaviour and disloyalty against di monarch". Nobody don see her face for public since that time and nobody bin sabi wia she dey.

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Di king latest decision mean say di image of "Sineenat Wongvajirapakdi never spoil", di Royal Gazette announced.
"From now, e go dey as though we no comot her military rank or royal decorations."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem born Sineenat for 1985, for northern Thailand wia she work as nurse before she enta relationship crown prince Vajiralongkorn.
She later become bodyguard, pilot and parachutist, and join di royal guards. For early 2019, she collect rank of major-general.
She receive official title of first Royal Noble Consort for July that year.

The true reason for her removal - and why dem return - as royal consort fit no ever enter public ear, because of how place mata for Thailand na secret something.














