Kim Yo-jong: Kim Jong-un don give im sister 'more responsibilities' - See wetin dem be

North Korean leader Kim Jong Un and his sister Kim Yo Jong attend a meeting with South Korean President Moon Jae-in at the Peace House at the truce village of Panmunjom inside the demilitarized zone separating the two Koreas, South Korea, April 27, 2018

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kim Jong-un and Kim Yo-jong are said to be close

North Korean leader Kim Jong-un don hand down more responsibilities to im aides, including im sister Kim Yo-jong, according to South Korea spy agency.

Mr Kim still maintain "absolute authority", but e hand down various policy areas to odas to reduce im stress levels, di spy agency report tok.

Ms Kim now dey in charge of "steering overall state affairs", di National Intelligence Service tok.

But, Seoul spy agency don dey wrong about North Korea in di past before.

According to reports, dem make dis claims during one closed-door briefing on Thursday to South Korea National Assembly.

Lawmakers come discuss di assessment with journalists

"Kim Jong-un still dey maintain im absolute authority, but e don hand down some of am over little by little," di agency bin tok according to report.

Ms Kim now dey responsible for Pyongyang policy towards di US and South Korea, among oda policy issues, and be di "the de-facto number two leader," e add, although e stress say Mr Kim "never select successor."

Mr Kim decision to delegate na partly to "relieve stress from im reign and wash hand comot in case of policy failure," e tok.

However, some analysts no trust dis info, di website NKNews note say e be like say she miss two important meetings dis month, wey make some pipo dey speculate say dem fit don demote her.

Kim Yo Jong, sister of North Korea"s leader Kim Jong Un, attends wreath laying ceremony at Ho Chi Minh Mausoleum in Hanoi, Vietnam March 2, 2019

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kim Yo-jong is the younger sister of Kim Jong-un

Who be Kim Yo-jong?

She be di younger sister of Kim Jong-un and di only one of inside im brothers and sisters wey pipo consider as im close and powerful ally.

Dem born am for 1987, she dey four years younger dan Mr Kim. Di two of dem live and study for Bern, Switzerland, at di same time.

Ms Kim first gained international attention for 2018, wen she be di first member of di Kim dynasty to visit South Korea. She bi dey part of di delegation to di Winter Olympics, wia North and South compet as joint team.

She also work alongside her brother for international summits, including for im meetings with South Korean President Moon Jae-in, China Xi Jinping and US President Donald Trump.

Presentational grey line

How reliable be dis South Korea spy agency?

North Korea na one of di world most secretive societies.

Even though South Korea National Intelligence Service fit get more intelligence about di North dan most oda organisations, dem still dey get mixed record.

For example, for 2016, South Korean media cite one similar briefing by di spy agency for wia dem say dem don execute di chief of staff of di North Korean army, Ri Yong-gi.

Three months later, di South Korean government say e be like say e dey alive, as im name bin appeared ontop one list of party officials.