COVID-19 Drama: Doctors declare say 2018 presidential candidate die but family say e go spiritual retreat

Di pastor

Wia dis foto come from, Kum Paul

    • Author, Leocadia Bongben
    • Role, BBC News Pidgin, Cameroon

Kontri pipo for Cameroon economic capital watch drama afta 2018 presidential candidate and prophet Franklin Ndifor die but family say e no die, say e go spiritual retreat.

Franklin Ndifor bin bi na pastor for Kingship International Church for Douala and odas bi challenge president Biya for 2018 elections.

De last taim weh deh see e for public na weh e go give tins for wash hand for population for block Covid-19.

De tori na say Dr Gaelle Nanga for Bonassama district hospital weh e check Franklin Ndifor tell tori pipo say de man of God die from Covid-19.

Na health authorities for littoral region bi send doctor Nanga, for go check de prophet.

But, e no bi clear why deh say e die of Covid-19 as deh announce for national radio if e no bi dey hospital or quarantine and if deh test e.

Cameroon don register 3105 cases for Covid-19, 1567 pipo don recover, 140 don die.

Pipo for front of his house

Wia dis foto come from, Kum Paul

Afta deh declare say Franklin Ndifor die for around 11:30 am, de family mimbas lock gate, no let any man inside, not even authorities.

Some taim afta, police start di kam small- small for late prophet e Bonaberi house, den later surround de whole house.

Finally around 4:00pm wen authorities enta de house, de family mimbas deh no let dem enta de room weh de keep de prophet e die bodi.

For dis taim, church pipo gada for front prophet e house di sing di pray, di wait for miracle, as police and oda security officials di keep guard.

De drama continue till evening wen police use force for enta de house.

Police kam take de die bodi around 7:30pm by force go bury'am, deh also arrest de prophet e mami and oda family mimbas say deh try for stop dem for take de bodi.

Wetin we call dis Video, Covid-19 in 60 seconds: Fake news fact check