Stress fit make woman no born boy pikin - Report

Woman wey get belle.

Wia dis foto come from, Getty Images

Women wey dey go through mental or physical stress wen dem get belle dey less likely to born boy, according to one new report.

Di study wey di Proceedings of the National Academy of Sciences for US do, also show say stress fit make woman wey get belle, born premature pikin.

"Di womb na very important first home for pikin dem," na wetin lead researcher Catherine Monk for Columbia University tok.

Inside di study, women wey get higher blood pressure and oda signs of physical stress bin get four boys for evri nine girls while mama dem wey get mental stress bin get two boys for evri three girls. All di women wey do di research bin get healthy pregnancies.

Around 30% of pregnant women dey complain of mental stress from dia work or depression and anxiety, according to di studies.

"Stress during pregnancy fit dey harmful for both mama and pikin," Laura Berman, assistant clinical professor of OB/GYN for di Feinberg School of Medicine tok.

Social support dey important

Mama wey dey feed her pikin

Wia dis foto come from, Getty Images

Pregnant women wey dey receive social support, weda na pesin wey dem fit dey follow gist or pesin wey fit dey helep dem wit dia problems, no dey get wahala wit premature birth, Monk tok.

Di one wey dey shocking pass na say di more social support mama dey receive, di more chance she get to born boy.

"Di support fit be from family, friends or religious community," Monk add.

Social support dey very important to build confidence for new mama, di researchers explain.