Former prisoner Alice Johnson go model Kim Kardashian West underwear

Kardashian West and Alice Johnson

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kardashian West campaign for di freedom of Alice Johnson
Read am in 1 mins

One 64 year old woman wey dem free from prison afta 19 years, go be model, to sell Kim Kardashian West new line of underwear.

Madam Kardashian West waka, even reach di White House for dem to release Alice Marie Johnson wey dem bin sentence to life imprisonment for her small role inside one drug trade for 1996.

Di TV star bin tweet one video of Johnson wey show her dey wear di new 'Skims shape wear.'

Johnson say, "Kim fight war for me, for my freedom, na why I call her my war angel."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dem sentence Madam Alice for 1996 for di first-time, for non-violent offence wen she work as "telephone mule", dey carry messages from drug distributors and sellers.

Obama bin refuse to pardon her for 2016, but Presido Trump reduce her sentence afta Kim Kardashian run campaign wey gada support of Trump son-in-law Jared Kushner.

Kim Kardashian don already enta wahala for dis her shapewear as she bin first call am Kimono Intimates for July. Some Japanese pipo react say na disrespect to dia traditional cloth, Kimono.