Rashida Tlaib and Ilhan Omar: Who be di two US Congresswomen and why dem deny dem to enta Israel?

Wia dis foto come from, Getty Images
Rashida Tlaib and Ilhan Omar, shake di world for November 2018 wen dem win seat for di US Congress as di first Muslim women for US history.
Di two women be members of di Democratic Party.
Dem get mouth on top issues like LGBT rights, support laws wey wan legalise abortion, and to support immigrants.
But e get one issue wey make dem different from everybodi for dia party for Congress.
Boycott controversy
Di two women dey strongly criticise di way Israel dey treat Palestinians, and dem be di only two politicians for di Congress wey dey openly support di Palestinian-led boycott movement wey dey target Israel.
Na so Tlaib and Omar take become di first elected representatives for US history wey dem deny from entering Israel.
But no be so e be for dia 72 oda colleagues from Congress wey enta Israel dis month all-expenses-paid tour.

Wia dis foto come from, Getty Images
Ilhan Omar and Rashida Tlaib bin dey plan fly go Israel to enta Palestinian territories under Israeli occupation: East Jerusalem and the West Bank.
End of Di one wey oda users dey read well well
As di mata for be, Congresswoman Rashida Tlaib, bin dey plan use di trip to visit her family.
Di 42-year-old na Palestinian-American lawyer from Michigan, wey her grandmama and oda relatives dey live for di West Bank.
Afta Israel no gree make she enta, Rashida Tlaib share one picture of her grandmama for Twitter come says, "Israel decision to bar her granddaughter, wey be US Congresswoman, na sign of weakness becos di truth of wetin dey happen to Palestinians dey shocking."
Civil rights struggle
She follow retweet one post wey show say South Africa's apartheid government no bin all well-known African-American civil rights activist and politician Jesse Jackson enta dia kontri.
Rashida Tlaib don describe Israel as "racist" kontri, sotay pipo tok say she be anti-Semitic.

Wia dis foto come from, GPO via Getty Images
For dis mata, di pesin wey Tlaib dey close wit pass na Congresswoman Ihan Omar from Minnesota, wey be 38-year-old hijab-wearing Somali-American, she enta US for 1995 as child refugee.
She tok say di ban on her and Rashida Tlaib to enta Israel ''na insult'', say e dey somehow say Israel, wey be kontri wey dey call imsef "di only democracy" for di Middle East, go do dis kain tin ''na insult to democratic values'.'
Ilhan Omar views on Israel don for public eye since she enta Congress.
Anti-Semitic Charges
Di most powerful pesin wey dey always counter di two women na President Donald Trump imsef, wey follow give Israel shoulder make dem no allow di women to enta.
Trump tok say di two congresswomen "na disgrace" den e come add say "e go show great weakness if Israel allow Representative Omar and Tlaib to visit".
''Dem hate Israel and all Jewish people and notin wey anybodi fit do to change dia minds," na wetin im write for Twitter.
Anti-boycott laws
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say den use di anti-boycott law to bar di two American congresswomen from visiting di kontri.
Under di law wey di Netanyahu goment pass for 2017, any foreigner wey halla make dem do any boycott wey dey target Israel - weda na economics, culture or academic - dem no go get visa.

Wia dis foto come from, Getty Images
Israel tok say di boycott movement na threat to dia existence, wey be sometin di US politicians from both sides of di Congress dey support.
Di two congresswomen don reject charges say e dey anti-Semitic make pesin do boycott.












