Boris Johnson na UK next Prime Minister

Wia dis foto come from, Reuters
Boris Johnson na di leader of di Conservative party afta majority of di 160, 000 Tory members vote for am. Im beat Jeremy Hunt to become di next prime minister.
Im go officially start work as di Prime Minister of Britain on Wednesday.
Outgoing PM Theresa May don congratulate am and she tok say she go support am through di process.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oga Johnson, wey be former mayor of London, don hold some big positions for gofment before.
Madam May, wey step down sake of her policy on Brexit, go head her last cabinet meeting today.
She go officially write her resign letter give di queen on Wednesday afternoon afta she do her last Prime Ministers Questions.








