Google pause Huawei from using Android

Wia dis foto come from, Reuters
Google don press pause for phone maker Huawei so dat dem no go fit use some updates ontop di Android operating system, wey be sucker-punch on di Chinese company.
New Huawei smartphones go also lose access to popular Google apps.
Di move land afta President Donald Trump goment for America add Huawei to one list of companies wey American companies no fit trade wit unless dem get licence.
Inside one statement, Google say dem dey "comply wit di order and dem dey also review di implications".
Huawei neva tok ontop di mata.

Wia dis foto come from, Chesnot
Wetin dis one mean for Huawei users?
Huawei no go fit get Google security updates and technical support any longer, and any new device weda na phone or computer no ge see apps like YouTube and Maps.
Huawei smartphone users currently fit update apps and push through security fixes, as well as update Google Play services. But if Google releases a new version of Android, Huawei no go fit go fit give dat update ontop dia phones.
Huawei fit still use di version of di Android operating system available through one open source licence.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ben Wood, from the CCS Insight consultancy, say di move by Google go get "big implications for Huawei consumer business".
Wetin Huawei fit do about dis?
Last Wednesday, Trump goment add Huawei to him 'entity list' wey go ban di company from collecting technology from American company witout government approval.
For dai first comment since dem put am for di list, Huawei chief executive Ren Zhengfei tell Japanese media on Saturday say dem don dey prepare for am.
He tok say di firm wey dey buy about $67bn (£52.6bn) worth of components every year according to di Nikkei business newspaper, go start to dey make dia own parts.
Huawei don dey face yabis from Western kontris wit US for front, sake of di risk wey dia products for next generation 5G mobile networks.
Plenti kontris don raise concerns say China go fit use Huawei gear to monitor pipo but di company don deny am.
Di company tok say make pipo no feel threatened and dat e no join bodi with di Chinese goment.
Still, some kontris don block telecoms companies to dey use Huawei products for 5G mobile networks.
Wetin be di short-time damege wey Huawei go suffer?
By Leo Kelion, BBC Technology desk editor
For di short term, dis fit damage Huawei for di West.
Pipo wey dey buy smart phone no go want android phone dey lack access to Google Play Store, di online assistant or security updates, if dem biit di services wey dem go oull..
For di longer term, e go mean say all di pipo wey dey make smartphones go gats look for new option to Google operating system, because say di search giant dey try to push dia Pixel brand.
As far as Huawei know, e don dey prepared for di chance say e go dey cut off from America know how.
Dia smartphones don already get dia own processors and early dis year,, di company consumer devices tell German newspaperDie Welt say "we don prepare our own operating system - that na our plan B."
Di move go stop dia ambition to pass Samsung to be di bestselling smartphone brand for 2020.













