Lagos Fashion Week 2018 for foto
Article Information- Author, Abdulmalik Fahd Abdulmalik
- Role, BBC News Pidgin
2018 Lagos Fashion Week don begin shele for di Nigeria economic capital.
Di first show get campaign on mental health awareness in Lagos, Nigeria wey dem call "The Dew Collection.".
Na magazine tori pesin, Betty Irabor arrange wit six oda Nigerian designers like Toju Foyeh, Mai Atafo and Ejiro Amos Tafiri
See some beta fotos from streetstyle to runway.
Wetin we call dis foto, Dis na Cynthia Abila collection wey she use recognise as women dey hustleDi event dey happen from 25 - 27 October, 2018.
Wetin we call dis foto, Guys no carry last as dem sef follow do slay kingsWetin we call dis foto, 17, 18, 19 ..... if you know, you know...Wetin we call dis foto, Menswear designer, Russell Solomon collection feature smart smart cloth for guysWetin we call dis foto, Ejiro Amos Tafiri design for part of di "Dew collection" wey follow chook eye for mental healthWetin we call dis foto, Many pipo like say dis year designers use plenti colour for dia clothWetin we call dis foto, Model Aduke Shitta-Bey be one of di fast rising models for Naija fashion industryWetin we call dis foto, Di runway wey di models go do yanga waka for di cloth dem dey wearWetin we call dis foto, Creative Coco Anetor-Sokei follow pose for our street-style editionWetin we call dis foto, You fit get tattoo like our guy hia?Wetin we call dis foto, Some pipo best accessory wey dem showcase na dia shoesWetin we call dis foto, Denge poseWetin we call dis foto, And for some pipo di best accesory dem get na dia smile