Air Niugini plane miss road land inside water for Micronesia

Wia dis foto come from, Reuters
One passenger aircraft don land inside lagoon off Chuuk International Airport for Micronesia afta e speed pass di runway, airport officials tok.
Foto dem show as di Air Niugini plane, from Papua New Guinea, siddon inside water wey no too deep near beach side.
None of di 35 passengers and 12 crew wey dey inside di flight ANG73 suffer serious injuries.

Wia dis foto come from, JAMES YAINGELUO
Dem neva sabi wetin cause di crash, but investigations go soon begin.
"Di plane crash for lagoon, about 160 yards away di runway," Chuuk airport manager Jimmy Emilio yan BBC.

Wia dis foto come from, Reuters
Oga Emilio say all di pipo wey dey di Boeing 737-800 aircraft don go hospital for checks, say im believe say some get "small wound".
Di plane bin dey fly from di island of Pohnpei for Micronesia to Port Moresby, di capital of Papua New Guinea, and e stop for Micronesia Weno island as e dey go.







