Will Smith dey go back to rapping ?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis World Cup get many tins wey remind pipo of 1998, from who win: France, to Will Smith rap movement.
While plenti pipo no really gbadun di World Cup song, e comot question: Weda di Fresh Prince wan enta back di rap game fully.
Dis dey come afta di 49 year old American actor perform World Cup song on Sunday for Russia 2018 closing ceremony.
Tori now be say Will Smith start to dey trend afta im perform for di World Cup final.
Apart from dat, since im open im instagram account for 2017, e don start to dey ova popular sef.
Im recent win na wen im do di #Inmyfeelings challenge wey one comedian, Shiggy bring on top di Drake song. Drake even say na im win am.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Apart from all di remix wey im don do for im pikin, Jaden Smith song, "Icon", im join bodi for di official song for World Cup fit be im big show say e wan enta back hip-hop.
Dis one no mean say e neva release song o. For 2017, e join bodi with im friend and dj Jazzy Jeff to release "Get Lit" but e get very bad review from sabi pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
But how di tori start?
Before Will Smith become di Fresh Prince, e be rapper wey go be di first one wey go win di Grammys for di first time for history for 1989.
Im make plenti money for im first album, "Rock The House," but according to am, "I no use sense take spend am."

Wia dis foto come from, Getty Images
But dat no be di end of im tori. As e enta soap opera game with "Fresh Prince of Bel-Air" , dat one no comot anytin for im rap blood as e start to dey grow for Hollywood.
E sometimes enta back into di rap game wen e comot with "Big Willie Style" among oda albums but no drop im acting career.
Im last major album drop for 2005 and e call am "Lost and Found".
E go fit make am if im enta now?
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
But no mata wetin happen to im career of rap, fans no want make e stop social media, because he dey jiggy with di social.