Stormy Daniels: Why police arrest America blue film actress wey get case against Donald Trump

Stormy Daniels

Wia dis foto come from, FRANKLIN COUNTY SHERIFF'S OFFICE

Wetin we call dis foto, Di Franklin County Sheriff Office na dem give dis mugshot picture
Read am in 1 mins

America blue film star, Stormy Daniels, don enta some wahala for strip club for Columbus, Ohio, US.

Dem arrest di porn star, wey her real name na Stephanie Clifford, on top say she touch customer for Sirens wia she dey perform. She don pay bail sha.

Her lawyer, Michael Avenatti, tok say wen and if dem cari her go court, she go deny di accuse say she touch pesin for club.

Im say na politics dey di mata of why dem arrest am.

Stormy Daniels bin enta tori afta she tok say she bin sleep with Donald Trump for 2006 wey e still no gree say happen.

Stormy Daniels

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Stormy Daniels don go pass 100 venues for di kontri to strip

According to di police charge sheet, she bin touch one police officer wey dey form say e be customer for one "specific part of bodi".

Her lawyer tweet say wetin she do for dia na "di same act wey she don do for pass 100 strip clubs all ova di kontri."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

She do release statement say she no go fit perform for anoda show wey she get for di same Colombus, say she dey very sorry to her fans.

According to document for di Franklin County Municipality Court, Ms Daniels don pay bail of $6,054 and suppose show for court on Friday.