Donald Trump no fit block pipo for Twitter - US Court

Donald Trum

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Trump get millions of followers for Twitter
Read am in 1 mins

One judge for New York don tok say e no dey law book say man like Donald Trump go dey block pipo for Twitter, say e dey against di First Amendment.

Judge Naomi Reice Buchwald wey handle di case tok say di president and im director for social media block pipo right to free speech wen dem block dem say dem tok sometin wey Donald Trump no wan hear.

Na Columbia University Knight First Amendment Institute and seven pipo wey Trump don block gada to sue di president on top di blockage.

Di oga pf di First Amendment Institute for Columbia University tweet di victory say na beta time make ogas for goment dem dey comot di pipo wey dem block for social media on top say dem no like wetin dem tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

But di court no order say make Donald Trump unblock pipo wey im don already block.

Donald Trump dey popular on top Twitter and don block celebrities like Chrissy Teigen, Stephen King and Rosie O'Donnell.