Royal Wedding: See how UK dey follow Meghan and Harry

The Sun
Wetin we call dis foto, Di wedding of Prince Harry and Meghan Markle na di main tori for many newspapers for UK. Na Windsor Castle di wedding go happen and Ms Markle don alreadi tok say di tin dey sweet her for belle.
The Mirror
Wetin we call dis foto, Ms Meghan mama, Doria Ragland, na di only family member of di famous actress wey go show for di wedding. She don alreadi meet Queen Elizabeth yesterday.
The Times
Wetin we call dis foto, Na Prince Harry papa, Prince Charles, go lead Ms Markle go altar after im hear say na wetin she want. E show say Meghan Markle and di man wey go soon become her father-in-law dey very close. Tori be say Prince Charles even follow choose di music wey dem go play on wedding day.
Daily Mail
Wetin we call dis foto, Tori pipo, di Daily Mail, tok say Meghan "solo feminist waka half way down di aisle" go make Saturday "a magically modern royal wedding".
Daily Express
Wetin we call dis foto, Daily Express nack quote from Princess Diana - Prince Harry mama - for dia front page: Di newspaper say Prince Harry dey look 'relaxed' as e dey prepare to end life as single man.
The i
Wetin we call dis foto, Na business tori pipo i dey look for di wedding. Dem say di collabo of wedding, sunshine and Russia 2018 World Cup don help di economy.
guardian
Wetin we call dis foto, Di Guardian put foto of Meghan Markle and her mama for dia front page, come add poem from Carol Ann Duffy.
Ft
Wetin we call dis foto, Di Financial Times no even tok about di royal wedding for dia front page. Instead, na di increase for pension 'cash-in' na im dem report.
Daily Star
Wetin we call dis foto, For di Daily Star, na di tori of how tiff steal gift from memorial of Alfie Evans. Alfie na di pikin wey die for April afta serious court case wey reach di High Court.
Prince Harry and Meghan Markle

Wia dis foto come from, Reuters