President Macron say thank you to di 'delicious wife' of Australia Prime Minister

Wia dis foto come from, Getty Images
France President surprise pipo for im visit to Australia wen im dey hail Lucy Hughes Turnbull, wey be di wife di Australia Prime Minister.
Di France presido dey visit di kontri to discuss big big tins like climate change and defence.
Macron talk say, ''I wan thank you and your delicious wife for evri evri during our ogbonge trip to Australia unto say evri tin dey on point''.
Tori pipo wey dey di press conference dey scratch dia head sake of say dem no sure weda na mistake dem hear or na insult wey comot for Macron mouth.
But wen dem check, dem see say na true o, Macron use ''delicious''.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis tori get part two unto say for France, délicieux, wey be di French version of delicious, fit mean somtin wey sweet.
But délicieux pesin fit mean correct pesin or pesin wey dey.
So wetin Macron talk no bad but for kontri wey no dey speak French, di meaning fit cause small tooth pain.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
France Presido Emmanuel Macron dey speak ten-ova-ten English, just last week for US, im use English blow lawmakers sotay dem give am standing ovation.
So dis kain mistake no be somtin im dey do evri time.










